Hannatu Musawa
Hannatu Musa Musawa (dem bon am on 1 November 1974) na Naija loya, politishan an pesin wey dey rait buk. Sins 2023, shi don dey wok as Minista for Art, Kolsho, Tourism an Creative Ekonomi. Shi kom fom Katsina State wey dey for northern Nigeria, an shi bi Hausa-Fulani by tribe.
How ha life stat an ha school journey
[chenj-am | chenj-am for orijin]Musawa na pikin of Musa Musawa, wey bi memba of one kaind strong and crious politikal parti for First Repoblic. Di nem of di parti na Northern Elements Progressive Union. Leta, for Sekond Repoblic, di parti turn to Peoples Redemption Party.
Shi get ha first university digre for lor wey mean say she sabi law wel wel fom University of Buckingham for UK. Afta dat one, shi du two master’s digres:
One for marine law (lor wey concern wota, sea an ship mata) fom University of Cardiff for Wales.
Anoda one for oil and gas lor fom University of Aberdeen.
Wok life
[chenj-am | chenj-am for orijin]Musawa don wok for meni difren plez an do plenti kainds of job. Shi don bi lorya for private kompanies, dey giv legal advis an dey represent pipu for lor mata. Shi sabi marine lor an oil & gas lor wel wel, wey mean say she get strong brain for plenti m hard topiks.
For 2023, President Bola Tinubu apoint ha as minista. Bifor dat one, shi dey wok as im speshial advisa on kolsho and entertainment ekonomi. Now, shi dey in charj of how Nigeria go promote an gro di creative sektor, an how dem go protet an sho Nigeria kolsho and histri.
How shi du Politis wok
[chenj-am | chenj-am for orijin]Musawa don join politis for Nigeria in difren ways. She don trai enta House of Representatives so dat shi fit represent ha pipu. Shi folo wok as lorya for 2003 presidential election court case wey dey bitwin Muhammadu Buhari an Olusegun Obasanjo.