Halima Atete

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search

Halima Yusuf Atete wey pipul no wel wel as Halima Yusuf (dem bon am for November 26, 1988) na Naijá aktress and fim produsa. Dem bon am for Maiduguri, Borno State an na dia e tek gro up. Halima na popula fim aktress for Kannywood flim industry for di rol wey shi dey akt as pesin wey jelosi wey kom get gragra tu. Shi enta Kannywood for 2012, Shi akt an produs e fest fim wey di nem na Asalina (My Origin), di nem of oda fim wey shi akt na Kona Gari, Asalina, Dakin Amarya, afta shi don akt plenti fim shi win best new aktress for the City People Entertainment Awards for 2013, Di London based news organization of African Voice pik am as di aktress wey tanda gidigba pas inside aktin an di entatenment indostri.

how shi tek stat life an wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na Maiduguri for Borno Stet dey tek bon Halima Atete.Shi go Maigari Primary School an shi go Yerwa Cc Government Day Secondary School. Shi kolet diploma in Sharia and Civil law.Halima enta Kannywood film industry for 2012, shi don akt ova 160 fim, di nem of som fim wey shi don produs na Asalina (My Origin), an Uwar Gulma (Mother of Gossip).