Jump to content

Hafsat Abdulwaheed

From Wikipedia

Hafsat Abdulwaheed Ahmed (dem bon on May 5, 1952) na Nigerian raita, pesin wey dey rait poem, an wuman pesin wey dey faight for wumen mata mek dem get beta laife an respect. She bi di first Hausa wuman from Northern Nigeria wey rait buk wey dem kari go market. Hafsat na fom Kofar Mata aria for insaide Kano City, for Kano State Nigeria.

Hafsat Abdulwaheed na Nigerian wuman wey dem bon on May 5, 1952. She dey rait buk mostly for Hausa langwej. Shi dey rait poem too an shi dey sopot wumen rights. Shi kom fom Kofar Mata aria for insaide Kano City, Northern Nigeria. Shi go Shahuci Primary School, an shi go secondary school wey dem dey call Provincial Girls School (wey dem leta chenj di nem to Shekara Girls Secondary School), all of dem dey insaide Kano State.


Shi stat to rait buk sins sh don dey primary school. On January 25, 1966, shi mari one man wey him nem na Muhammed Ahmed Abdulwaheed. For earli 1970s, na shi bi di first Hausa wuman wey ha novel enta market. For 2000s, shi trai run for govnor for Zamfara State wey dey Northern Nigeria. Shi don rait pas 30 buks, but na only five of dem dem don poblish. Shi get chudren an ha first pikin na Kadaria Ahmed, wey be journalist.

Hafsat stat to rait sins shi don dey primari skul. Dat tiame, shi dey rait old stories wey people dey tell for village. Shi win prize for som of the stories wey shi rait. One taime, British Council giv ha awod wen shi stil dey primary four or five.

For 1970, shi send one stori wey shi rait wey dem kol So Aljannar Duniya (wey mean “Love na Paradise for Earth”) go one writing competition wey Northern Nigerian Publishing Company (NNPC) du. Shi rait di stori wen shi dey primari five. The story na about wetin ha elder sister fez wen shi mari one Libyan man. Dia marej get wahala bikos of di difren kolsho wey dem get. Hafsat kom wok on di stori again, edit am wel bifor shi submit am.

Na dat stori bi ha most popula buk. Di buk kari sekond posishon for di Kompetishon. So Aljannar Duniya na di first buk wey opun road for one kain Hausa lov stori buks wey dem dey kol Littattafan Soyayya (Lov Buks), an som pipu stil kol am Kano Market Literature. One wuman wey ha nem na Cara Giaimo tok sey two Hausa scholars—Abdallah Uba Adamu an Graham Furniss—tok sey di buk na di one wey stat di lov-stori raitin muvment for Hausa pipu.

Oda buks wey Hafsat don rait:

.Yardubu Mai Tambotsai ("Yardubu the Possessed" – stori)

.Nasiha ga Ma'aura (Advis for pipu wey don mari – real laife tok)

Namijin Maza Tauraron Annabawa (real laife stori abaut Prophet Muhammad)

.Ancient Dance (na poetry buk an na ha first buk wey shi rait for English)

Hafsat na memba of one wumen grup for Nigeria wey dem dey kol Baobab. Afta Nigeria return to democracy for 1999, di grup notis sey for Zamfara State, dem no kari eni wuman join pipul wey dey wok klose to govnor. Hafsat dey liv for Zamfara with ha hosband dat taime.

Shi sey: "Di leaders of di grup go meet di govnor to tok sey dem no hapi sey no wuman dey for di cabinet. I no follow dem go bikos I no sabi keep quiet if I ci say sometin no koret.

"Wen dem kom bak, dem tel me sey govnor tok sey no wuman for Zamfara get gud edukeshon to wok for im cabinet. I vex bikos for my own hauz, my daughters sabi buk wel wel.

"Na dat taime I tok sey, 'We no go onli ask for commissioner seat, we go kolet govnor seat join.’ I kom decide sey I go run for govnor for next eleshon.”

But di tin no wok. Shi sey, “You know sey for North, e scars mek wuman sey shi wan do enitin for poblik, tok less of to bi leader.”

Som Muslim scholars kom vex abaut ha decishon, an di politika parti wey shi wan folo contest kom withdraw sopot. At the end, ha papa kom beg ha mek shi forget di idea, even though shi don print poster an do campaign materials.

Wia dem gada tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]