Greenhouse gas emission

From Wikipedia

Di way human bein dey du tins dey mek di Wold or Earth dey hot more more an oyinbo pipul dey kol dis tin Greenhouse gas emmision. Dis hativitis dey korse klimet chenj. Di mejo tin wey dey korse mek di wold dey hot more more na as one gas wey bi Carbon dioxide wey dey komot wen dey put faya on somtin. Wen pesin yuz Coal, petirol an gas to put faya to somtin, dis Carbon dioxide gas dey always komot enta breeze. Di kontri wey dey burn or rilis dis gas pass na China bikos dey too dey yuz Coal. Odas tins wey dey mek Carbon dioxide plenti na pipul wey dey yuz plenti oil an gas du tins. Anoda tins wey dey mek Carbon dioxide gas plenti na how pipul dey get heletrisiti or light. One hoganizashon wey dey tok abaut am di United States Environmental Protection Agency tok sey to dey transpot light from one ples to anoda mek up of 27 pacent of greenhouse gas emmison in USA. As pipul dey not down tress an dey levul forest an bush dey mek di hafet of greenhouse effect plenti more an more bikos anoda gas kol methane dey folo enta breeze too. Some kontena wey get all dis gas fit dey lik an Dis one sef dey hafet di klimet chenj. Somtim, Agrikolshoral pratis like to dey dig graund an di kind fataliza wey pipul dey yuz fit rilis gas like methane or nitrous oxide to di air. Air kondishon an fridge sef fit inkreas di Kliment chenj bikos som gas like fluorine fit get dia way enta air.