Grace Atinuke Oyelude
| Man abi wuman | wuman |
|---|---|
| Kontri wey e kom from | Naija |
| Fest nem | Grace |
| Wen dem bon am | 16 November 1931 |
| Ples wey dem bon am | Kano |
| Wok wey e dey du | nurse |
| Wie e go skul | St Thomas's Hospital Medical School |
| Competition won | Miss Nigeria |
Grace Atinuke Oyelude (dem bon am on 16 November 1931) na bifor bifor nurse, midwaif, an pesin wey bon bi Oga for hospital mata wey pipu sabi wel wel afta shi win fest Miss Nigeria in 1957.
How shi stat life
[chenj-am | chenj-am for orijin]Dem bon Oyelude on 16 November 1931 in Sabon Gari, Kano, Nigeria. Na James Adeleye Oyelude an Martha Jasmine Dantu of Isanlu, Kogi Stet pikin. Na for Nothern Nigeria e tek gro. Shi du primari an sekondri edukeshon insaid 1940 an 1952 for Kano, Afta shi stat wok wit UAC.
Miss Nigeria
[chenj-am | chenj-am for orijin]Insaid 1957, wen shi stil dey wok for UAC, shi go stan for Northern region for Miss Nigeria afta im broda hep am send Daily Times ha pisho. Moni wey shi win insaid di kompetishon shi gada togeda to go nursing skul for England.
Pasonal life
[chenj-am | chenj-am for orijin]Oyelude get chief title as di Iyaolu of Isaluland an Iyalode of Okunland, an shi get plenti gran chudren. Insaid 2015, Miss Nigeria dash am niu Peugeot car.