Jump to content

Glory Edim

From Wikipedia

Glory Okon Edim na Nigerian-American wey dey rait buk an du biznes. Dem sabi am wel-wel as di pesin wey stat di reading network wey dem kol Well-Read Black Girl. For 2017, dem give am di Innovator's Award for di Los Angeles Times Book Prize bikod of di work wey shi dey do.

Earli Life an Edukeshion

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Glory Okon Edim na for Arlington, Virginia, dem bon am an shi tek gro. Ha papa an mama na Nigerian piou wey survive di Biafra war. Ha papa komot go bak to Nigeria for early 90s, wen shi stil smol. Wen shi dey kindergarten, shi an ha mama waka go meet am for Nigeria, but dem leta return go America afta shi sick. Ha mama wey bi histri ticha bifor, leta go stodi nursing. Dem dey travel go Nigeria plenti taimes go ci ha papa.

Edim first go Trinity College, wey give am full scholarship, bifor she waka go Howard University, di sem school wey ha papa go. Na journalism shi go stodi.

For 2015, wen Edim muv go New York City, shi open Well-Read Black Girl (WRBG) for Instagram. Shi love to read book, an na her boyfriend first call am "Well-Read Black Girl" put for t-shirt wey e give am as gift. Strangers for train dey holways ask ha abaut di shirt, an na so dem go stat to yarn abaut di buk wey shi dey read.

Evri taime wey shi post for Instagram, shi go put pisho of one African-American wuman wey bi raita, kon add one quote fom di pesin. Shi tok sey plan for WRBG na to build one community wey Black wumen fit uze tok abaut di buks wey Black wumen rait. Plenti Black wumen stat to yarn for di comment sekshon, na im mek Edim stat di WRBG book club for Brooklyn. Raiters lik Naomi Jackson an Katrice Barnett sef join di meetins wen shi invite dem.

Wit di hep of one raita wey dem dey kol Tayari Jones, shi plan mek WRBG turn yearly buk festival. For June 2017, shi uze Kickstarter (wey bi di kompini wey she dey wok full-time) tek raise $40,000 for di event. Di first festival hapun for Brooklyn for September 2017, an e sel out finish.

On October 30, 2018, shi poblish one buk wey bi collection of difrent raiters' stories. Di buk nem na Well-Read Black Girl: Finding Our Stories, Discovering Ourselves (Ballantine Books). Shi uze di wok of Toni Cade Bambara tek len how shi go arenj di buk. Insiade di buk, shi put stories fom difren raiters lik Morgan Jerkins, Jacqueline Woodson, an Jesmyn Ward. Na shi rait di foreword.

Edim tok sey di buk na to bring di sem feeling wey pipu dey get for buk klub—wia e bi lik sey pesin dey sit down near you dey tell you sweet an pasonal tori. Pipu wey read di buk tok sey e mek sense wel-wel. For LA Review of Buks, Utibe Gautt Ate tok sey di buk dey ask one simpu but deep question: "Wen you first ci yoursef for insaide buk?" E mek plenti Black wumen writers rememba how dem tek stat as Black girls wey dey read buk. Publishers Weekly tok sey di buk fit touch enibodi, but e go swit Black women pas.

Edim dey plan two more books—one memoir wey shi go kol Raised By Books, an another Wel-Read Black Girl anthology.

Awods wey shi don win

[chenj-am | chenj-am for orijin]

.Innovator's Award – Los Angeles Times (2017)

.Hurston/Wright Merit Award – Hurston/Wright Foundation (2019)

.NAACP Image Awards (Nominee) – Outstanding Literary Work – Instructional (2019)

Wia dem gada tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]