Gambo Sawaba
Hajia Gambo Sawaba (15 February 1933 – 14 October 2001) na Naija wuman raits aktivist, politishian, an pesin wey dey hep pipul.[1][2] Shi bi deputi chairman for Great Nigeria People’s Party (GNPP) and also lid di wumen grup for Northern Element Progressive Union (NEPU).[3]
Tori abaut ha famili and wia shi kom fom
[chenj-am | chenj-am for orijin]Im papa and mama
[chenj-am | chenj-am for orijin]Gambo papa nem na Isa Amartey Amarteifio (dem dey kol am Theophilus Wilcox bifor) wey bi Ghana man wey muv kom Naija araund 1910 to wok wit Nigerian Railway. Ha mama nem na Fatima Amarteifio wey bi Nupe wuman from Niger State.[1]
Hau dem tek bon am
[chenj-am | chenj-am for orijin]Dem bon Gambo for Zaria. Ha papa konvat to Islam afta e rich Zaria and mari Fatima, wey don already get 3 pikin from ha fest hosband. Gambo na di 5th pikin out of 6 children.
Bikos of hau dem dey giv nem for Hausa tradishon, eni pikin wey dem bon afta twins go ansa Gambo, so na so shi tek get di nem Hajaratu Gambo.[1]
Hau shi tek stat laif and go skul
[chenj-am | chenj-am for orijin]Shi go Native Authority Primary School for Tudun Wada, bot shi stop skul afta ha papa kpai for 1943. Ha mama kpai 3 yias leta. For jos 13 yias old, dem mari ha to Abubakar Garba Bello, one World War II soja wey run liv ha afta shi get bele.
Shi mari again leta bot di marej no last - one end bikos of plenti fait bitwin ha and di hosband.[3]
As pikin, Gambo dey kia for mad pipul, giv dem fud, klot, and moni. Pipul say shi tu stobon and no dey gri nonsens - if shi si pesin dey bit anoda pesin, shi go shaut “I don bai di fait from you” and tek ova di fait.[1]
Hau shi tek du politis and fait for pupil raits
[chenj-am | chenj-am for orijin]Shi enta politis from age 17. Dat time, Na north Naija dey onda kontrol of Northern People’s Congress (NPC), wey British pipul and Emirs dey sopot. Bot Gambo join oponet pati: NEPU (Northern Element Progressive Union).[4]
Shi fait against: smol pikin marej, mek dem fos pesin wok, and as gel pikin no get skul.
Shi tok for big politikal mitin wey plenti men ful, somtin wey wuman no dey du for dat taim. Ha mento na Funmilayo Ransome-Kuti, and shi travul go Abeokuta go mit ha.
Ha ril nem no bi "Sawaba" - na Malam Aminu Kano giv ha dat nem, wey min "fridom or ridemshon", wen shi bikom president of NEPU women’s wing.
Hau dem tek dey rimemba am
[chenj-am | chenj-am for orijin]One general hospital for Kaduna get ha nem. One hostel for Bayero University, Kano also get ha nem.[5]
Hau shi tek go prison
[chenj-am | chenj-am for orijin]Gambo go prison 16 taims bikos shi dey tok against child marej, forced wok, and unfair tax. Shi fait mek wumen get wok, gels go skul, and all wumen fit vote.
Pipul ivun tok say shi na di wuman wey go prison pas for Naija. Shi get one speshial blanket wey dem rait 'Prison Yard' on top - shi dey kari am go eniwia, redi for arest enitaim.
Wia dem gada di tori
[chenj-am | chenj-am for orijin]- ↑ 1.0 1.1 1.2 1.3 Kwewum, Rima (2004). THE GAMBO SAWABA STORY (second ed.). Abuja: Echo Communications Limited. p. 52. ISBN 978-37305-0-9.
- ↑ Paul, Mamza. "Nigeria's Unsung Heroes (10). Feminism As a Prowess: The Profile of Chief (Mrs.) Margaret Ekpo and Hajiya Gambo Sawaba". Gamji. Retrieved 21 April 2025.
- ↑ 3.0 3.1 "Hajia Gambo Sawaba". NigeriaGalleria. Galleria Media Limited. Retrieved 21 April 2025.
- ↑ Agunbiade, Tayo. "Hajiya Gambo Sawaba: 'The most jailed Nigerian female politician'". Al Jazeera. Retrieved 2025-04-21.
- ↑ Ibrahim, Tijjani (22 February 2020). "Help, our toilets are bad – BUK students". Daily Trust. Archived from the original on 23 February 2020. Retrieved 21 April 2025.