Funmi Falana
Funmi Falana na loya and wumen raits aktivist wey dey always tok for wumen mata.
Tori abaut ha laif and skul
[chenj-am | chenj-am for orijin]Shi bi Femi Falana wife – im na popula Naija loya and aktivist. Na dem bon Falz wey be muzishan and akto.[1]
Shi go St. Louis Girls’ Grammar School, for Akure, for Ondo State. Shi stodi Physics for University of Benin, den go rid Law (LL.B) for University of Lagos, wia shi stil kolet ha Master’s Degree (LL.M).[2]
Wok wey shi du
[chenj-am | chenj-am for orijin]Funmi Falana na di National Director of Women Empowerment and Legal Aid (WELA), NGO wey dey difend wumen and pikin dem raits.[3]
Shi dey pat of Nigerian Bar Association, West African Bar Association, and International Bar Association. Shi also bi memba of Chartered Institute of Arbitrators.
Hau shi tek lid and fait for pipul raits
[chenj-am | chenj-am for orijin]Shi don lid plenti kampen against rape, wumen marginalization, and for more wumen to join for politis and decision-making.[4]
Shi and ha oganaizeshon chalenj Police Act Regulation 124 wey tok say wumen polis no fit mari until afta 3 yias for wok – kot kansul am say e dey du pashia against wumen.
Shi rait leta to Inspector General of Police mek dem tek one wuman polis ofisa, Corporal Omotola bak, wey dem sak bikos shi get bele and no mari. Shi tok say if dem no tek ha bak, shi go kari di mata go National Industrial Court of Nigeria.[5]
Wia dem gada di tori
[chenj-am | chenj-am for orijin]- ↑ Ndaji, Simeon (5 August 2012). "Femi Falana left me at the mercy of judges – Funmi, wife". Vanguard News. Retrieved 2025-04-25.
- ↑ "Mrs. Funmi Falana". Falana & Falana Chambers. Retrieved 2024-04-25.
- ↑ Olabiyi, Lukmon (5 March 2016). "Falana alert FG of abduction of another teenager in Zamfara". The Sun News. Retrieved 2025-04-25.
- ↑ "How I met my husband — Funmi Falana". Punch Newspapers. 2020-04-12. Retrieved 2025-04-25.
- ↑ "'Reinstate dismissed pregnant police woman or face legal action'". Latest Nigeria News, Nigerian Newspapers, Politics. 2021-02-02. Retrieved 2025-04-25.