Funke Bucknor Obruthe
Funke Bucknor-Obruthe na Nigerian biznes wuman wey stil bi lorya. Shi bi di founder an Oga patapata of Zapphaire Events, an pipu sabi am as one of di first event planners for Nigeria.
Earli laife an skul mata
[chenj-am | chenj-am for orijin]Funke Bucknor-Obruthe na Lagos, dem bon am on 27 June 1976. Ha papa an mama na Segun an Shola Bucknor. Shi stat ha primary and secondary skul for Fountain Nursery and Primary School an Nigerian Navy Secondary School, all na insaid Lagos. Afta dat, shi go stodi Lor for University of Lagos. By year 2000, shi don complete lor skul for Abuja an dem kol am to bar, meanin say shi don qualify as lorya.
Wok
[chenj-am | chenj-am for orijin]Afta shi wok smol as lorya, shi wok for Tie Communications, one advertising kompini. But bikos shi lik event plannin well-wel, shi decide sey shi go stat her own kompini. So, for 2003, shi opun Zapphaire Events, wey bi kompini wey dey arenj an plan difren events. Sins dat taime, shi don organize plenti big events, both for Nigeria an outside di kontri. Shi even sho for CNN Insaide Africa bikos shi plan one Nigerian royal wedding.
She don collect plenty awods, lik:
.Future Awards for Entrepreneur of the Year (2006)
.Wedding Planner Magazine Award for Wedding Planner of the Year (2007)
.Go2girl Life Achievement Award (2011)
.Nigerian Events Award for Outstanding Contribution to the Events Industry (2012)
Buks wey shi don rait
[chenj-am | chenj-am for orijin].The Essential Bridal Handbook
Recognition
[chenj-am | chenj-am for orijin].For 2014, YNaija online magazine put ha nem for dia list of 10 Most Powerful Under-40s in Biznes.
.For 2016, BBC put ha nem for dia 100 Women series.
Pasonal Life
[chenj-am | chenj-am for orijin]Funke Bucknor-Obruthe mari Onome Obruthe, an dem get two chudren. Na shi bi sinior sista of late Nigerian media personality, Tosyn Bucknor.