Jump to content

Francesca Ekwuyasi

From Wikipedia

Francesca Ekwuyasi na Nigerian-Canadian raita an artist. Shi dey popula bikos of ha fest novel wey dem kol Butter Honey Pig Bread, wey dem poblish for 2020.

Earli laife an wok

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Shi kom fom Lagos, Nigeria, but nau shi dey liv for Halifax, Nova Scotia. Apat from raitin, she don do art exhibition for Halifax The Khyber for 2019, wia shi sho paper cutout art. Shi don dairet shot dokumentary fims lik Reconcile an Black & Belonging.

Butter Honey Pig Bread join for the 2021 edition of Canada Reads, wia celebrity chef Roger Mooking defend am. The book enta longlist for 2020 Giller Prize, an e rish finalist for difren awods lik 2021 Lambda Literary Award for Lesbian Fiction, 2021 ReLit Award for Novel, Amazon.ca First Novel Award, and 2020 Governor General's Award for English Fiction. For 2022, na shi win Dayne Ogilvie Prize.

Personal laife

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Plenti pipu sabi am as queer.

YearBookAwardCategoryResultRef
2020 Butter Honey Pig BreadGiller PrizeLonglisted
Governor General's AwardFiction in EnglishShortlisted
2021 Amazon.ca First Novel AwardShortlisted
CBC Canada ReadsNominated
Lambda Literary AwardLesbian FictionShortlisted
ReLit AwardNovelShortlisted
2022 Dayne Ogilvie PrizeWon