Jump to content

Florence Ozor

From Wikipedia
Florence Ozor

Florence Ozor (wey dem bon fo 1980) na Naija wuman-raits aktivist an biznes wuman, an shi bi one of di pipul wey stat di Bring Bak Awa Gels muvment. Pipul don kol am "rezolut feminis" (wuman wey strong fo fait fo wuman mata).[1]

Hau shi stat laif

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Florence Ozor na pikin wey dem bon fo 1980 fo Lagos, Naija.[1] Shi bi di midul pikin fo haos wey get five gels. Shi go skul go stodi histri an intanashonal rileshons (hau kontri dem dey rilet wit ich oda), an shi also do lidaship trenin fo Lagos, Havard an Singapore.[1]

Wok wey shi don do

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Ozor don wok fo meni kaind waka dem laik fashon, manufakchorin (hau pipul dey mek tins), advataizin (hau dem dey promot biznes) an poblik rileshons (hau biznes dey rilet wit pipul). Leta, shi setul fo koporet komunikeshon an how to rilet wit govment sins araund 2010.[1]

Fo 2014, Ozor spend som wiks fo Washington D.C. as one of di 23 wuman wey dem pik fo US Stet Dipatment Global Wumans Mentoring program (na program wey dey tren wuman lidas).[2] As part of di program, shi travul raund Colorado to tok fo meni ples, an shi tok abaut how di gels wey mis stil dey sofa, sey di wold dey foget dem.[3][4]

Stil fo 2014, Ozor go Wumans Lidaship Retrit fo Entusi Rizot fo Uganda. Shi mek evribodi wey kom dat event tek foto bihaind Bring Bak Awa Gels bana an shi yan wit Newswik abaut di mata.[5]

Ozor bi one of di two pipul wey sain one Bring Bak Awa Gels pres stetment fo October 2017, wey dem taitul: “Mista President, taim to akt na nau,” togeda wit Obi Ezekwesili. Dem tok sey na day 1,277 an 113 of di gels stil dey kaptiv.[6]

Shi don stat Florence Ozor Foundation, wey bi NGO (non-govment oganaizeshon) wey no dey du fo profit, an dem fokos on hau to tren wuman an gels an giv dem pawa fo Naija.[1]

Ozor stil tok fo one konfrens fo Brussels, Belgiam fo September 2017, wey dem taitul “Political Empawerment of Wuman fo Afrika an Yurop”. Di konfrens na Global Progressive Forum an PES Wuman oganaiz am as pat of 2017 Afrika Week.[1]

Wia dem gada di tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]
  1. 1.0 1.1 1.2 1.3 1.4 1.5 "Meet Florence Ozor, fighting for women and girls caught in conflict - Global Progressive Forum". www.globalprogressiveforum.org. Archived from the original on 2 January 2021. Retrieved 12 April 2025.
  2. "Learning to lead in a crisis". fortune.com. Retrieved 12 April 2025.
  3. "Businesswoman, activist Florence Ozor speaks in northern Colorado about Nigeria, agriculture". greeleytribune.com. Retrieved 12 April 2025.
  4. "Activist Fighting To Free Nigerian Girls: 'Nothing Else Matters'". cbslocal.com. 12 December 2014. Retrieved 12 April 2025.
  5. "The Stolen Girls of Nigeria Are Still Not Home". newsweek.com. 19 September 2014. Retrieved 12 April 2025.
  6. "Mr President, time to act is now - Bring Back Our Girls". www.bringbackourgirls.ng. Retrieved 12 April 2025.