Jump to content

Florence Orabueze

From Wikipedia

Florence Onyebuchi Orabueze na poet, raita, an Nigerian professor wey dey tich English an literary studies. Na shi bi di bifor bifor diarekto for di Institute of African Studies for ha school, di pesin wey stat di Grace Uzoma Okonkwo Foundation, an shi bi memba for Nigerian Academy of Letters.

Earli life an Edukeshon

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Orabueze on 30 March, 1966, for Enugu-Ezike, wey dey insiade Igboeze Local Government Area for Enugu State. Shi kom fom Anambra State, Uruagu, Nnewi, insaide Nnewi North Local Government Area.

Fom 1973 go rish 1979, shi go Uruagu Nnewi Central School (St. Mary's), wia shi tek get ha First School Leaving Certificate. Shi kon enta Girls' Secondary School for Uruagu, Nnewi, wia shi finish for 1984 an kilet ha West African School Certificate.

Shi get admission for University of Nigeria, Nsukka (UNN), wia shi stodi English Language an Literature fom 1984 go rish 1988. For 1991, di sem university giv ha master’s digre for Teaching English as a Sekond Langwej.

Fom 1993 go 1998, shi stil stodi Law (Bachelor of Laws) for di sem school, an by 2000, shi don finish di Nigerian Lor School for Bwari, Abuja. On 14 October 2000, dem kol ha to Nigerian Bar, wey mean sey shi don turn ful lorya. For 2011, shi do ha doctorate digre for English, wey focus on Afrikan literature, fom di Faculty of Arts, Department of English Language an Literary Studies, UNN.

Orabueze stat ha tiching wok as Assistant Lecturer for di Department of English, UNN, for 1996. By 1997, dem promote ha go Lecturer II, an by 2000, shi don rish Lecturer I. For 2004, na shi bi Sinior Lecturer, an leta shi turn Professor of English for di University of Nigeria. On 11 May 2017, shi giv ha inaugural lecture.

For 2019, dem publish one book wey dem tek honor ha, di nem na Perspectives of Language, Literature an Human Rights.

Administrative Posishons

[chenj-am | chenj-am for orijin]

.Fom 2011 go 2012, na shi bi di aktin coordinator for di Use of English Unit under School of General Studies for UNN.

.From 2010 go 2013, shi wok as Development Officer for di 13th Vice-Chancellor of di university.

.Insaid 2015 an 2019, na shi bi di first wuman wey dairet di University of Nigeria Bookshop.

.For 2015, she stil bi di first wuman wey direct University of Nigeria Press Ltd, an shi get di position til 2019.

.For 2019, shi turn Direkto for di Institute of African Studies, an shi stay di posishon til 2021.


Membership an Fellowship

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Orabueze na member for different organizations:

.Nigerian Academy of Letters

.African Literature Association (ALA)

.Linguistic Association of Nigeria (LAN)

.Modern Languages Association of Nigeria (MLAN)

.West African Association of Language, Literature an Linguistics Teachers (WALLTA)

.Women Caucus of African Literature Association (WOCALA)


Shi Fellow for:

.Nigerian Institute of Chartered Arbitrators

.Institute of Chartered Mediators an Conciliators

.Society for Research an Academic Excellence She be Life Member for Nigerian Academy of Letters an Nigerian Bar Association.


Orabueze mari Alexander Ogochukwu Orabueze, wey bi chartered accountant, on 17 December 1988, for Holy Ghost Cathedral, Enugu. Di marriage dey bless wit four chudren.

Selected Publications

[chenj-am | chenj-am for orijin]

.The Creative Writer as a Human Rights Activist (2017)

.Society, Women an Literature in Africa (2010)

.Essay in Honor of Professor Florence Onyebuchi Orabueze, Perspective on Language, Literature & Human Rights (2019)

.The Prison of Nigerian Woman: Female Complicity in Sefi Atta’s Everything Good Will Come (2010)

.The Feminist Crusade Against Violation of Women’s Fundamental Human Rights (2004)

The Dispossessed in Chimamanda Ngozi Adichie’s Purple Hibiscus an Half of a Yellow Sun (2011)

.Art, History, Religion an Literature: di Iconoclasts in Chinua Achebe’s Things Fall Apart (2020).

Wia dem gada tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]