Florence Obi
Florence Banku Obi na Nigerian ticha, buk raita, an profesor wey sabi plenti for edukeshon, espeshialy for psychology an how to tich pipu wey get speshial needs. Na Shi bi di 11th real Vice Chancellor for University of Calabar, an shi bi di first wuman wey don eva dey dat posiehon sins dem stat di school.
Afta dem appoint ha as di new VC, Senator Ovie Omo-Agege wey be di chairman for Senate Adhoc Committee on Constitution Review tok sey Prof. Obi na "correct pesin wey sabi buk wel wel." Bifor dis posishon, shi don bi deputy vice-chancellor for academics an shi don sarf as commissioner for wumen affairs for Cross River State bifor. Shi fest trai run for di VC position for 2015 but shi no win, na for 2020 shi finally win as di first wuman wey go bi VC for di school. For 2007, shi folo wok as social development commissioner an member of exekutiv council for Cross River State.
Earli life an Edukeshon
[chenj-am | chenj-am for orijin]Florence Obi come kom Bansan–Osokom for Boki Local Govment Aria insaide Cross River State. Shi stat ha primari school for St Bridget's Primary School, Ogep Osokom, Boki, Cross River State, wia shi tek get ha First School Leaving Certificate (FSLC) for 1969. Afta dat, shi go St. Thomas's Teachers Training College for Ogoja, Cross River State, an shi graduate for 1983. Shi get ha university digre for speshial education for University of Calabar. For 1990, shi get her Master’s digre (MEd) for di sem school. Leta, shi travu go Jordanhill College wey dey abroad, wia shi get Postgraduate Certificate in Education (PGCEE) for 1993. By 2002, shi kon get ha PhD for psychology of education for University of Calabar.
Academic wok
[chenj-am | chenj-am for orijin]For 1990, Florence Obi stat work as assistant lecturer for Institute of Education insaide University of Calabar. By 1992, shi win one six-month scholarship wey kari ha go Jordan-Hill College of Education onda World University Service (WUS), World-Wide Fund for Nature (WWF), an Nigerian Conservation Foundation (NCF). Di scholarship na for staff wey dey work for Institute of Education.
Afta di scholarship, shi kon dey in charge of di WWF/NCF schools and community education programme. By 2007, shi don bi profesor for speshial needs education.
Personal Life
[chenj-am | chenj-am for orijin]Florence Obi don mari an shi get four chudren an six grandchudren.