Jump to content

Flora Nwapa

From Wikipedia

Florence Nwanzuruahu Nkiru Nwapa (13 January 1931 – 16 October 1993) na one Nigerian raita wey dem dey kol "mama of modern African literature." Shi bi di first African wuman wey rait novel for English wey dem poblish for Britain. Ha fest buk Efuru, wey shi rait for 1966, mek meni pipu sabi ha for di whole world. Even though shi no kol hasef feminist, shi sabi how to sho di life an tradishon of Igbo wumen for ha stories.

Shi no just rait buk, shi stil hep wumen mek dem get beta place for society. Na shi first stat one of di first poblishing kompini for African wumen wen shi opun Tana Press for 1970. Afta Biafra War, shi folo govment wok to hep rebuild di society, espeshialy to tek care of pikin wey no get papa an mama an pipu wey war mek dem komot fom dia hauz.

Ha Life an Edukeshon

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Flora Nwapa na Oguta woman fom Imo State, Nigeria. Shi bi di first bon for ha papa an mama, Christopher Ijeoma (wey wok for United Africa Company) an Martha Nwapa (wey bi drama ticha). Shi go primari school for Oguta, shi stil go secondary school for Elelenwo, Rivers State, bifor shi waka go CMS Girls School for Lagos. Di school leta join anoda school for Ibadan, wey dem kol St Anne's School.

Wen shi rish 22 years for 1953, shi stat university. By 1957 (26 years old), shi don get B.A digre fom University College, Ibadan. After dat one, shi travu go Scotland go du Diploma for Education for Edinburgh University.

Flora Nwapa get three pikin: Ejine Nzeribe, Uzoma Gogo Nwakuche, and Amede Nzeribe. Shi mari Chief Gogo Nwakuche.

Ha uncle, A. C. Nwapa, na di first Minister of Commerce an Industries for Nigeria. Dis one dey inside di documentary "The House of Nwapa" wey Onyeka Nwelue do.

Ha wok for teaching an govment

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Wen shi kom bak to Nigeria, shi stat wok for Ministry of Education for Calabar as Edukeshon Officer until 1959. Afta dat one, shi stat to dey tich English an Geography for Queen's School, Enugu fom 1959 to 1962. Shi leta wok for difren govment posishons, lik Assistant Registrar for University of Lagos (1962–67).

Ha buks an poblishing wok

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Flora Nwapa fest buk Efuru (1966) na one of di first novel wey African wuman rait for English. Shi send di buk giv famous raita Chinua Achebe for 1962, an e lik am wel wel. Achebe even send moni mek shi fit send di buk go poblisha (Heinemann).

Afta Efuru, shi rait meni oda buks lik:

.Idu (1970)

.Never Again (1975)

.One Is Enough (1981)

.Women Are Different (1986)

Shi stil rait shot stories an poetry buks lik:

.This Is Lagos and Other Stories (1971)

.Wives at War (1980)

.Cassava Song and Rice Song (1986)


For 1974, shi opun Tana Press, an leta for 1977, shi stat Flora Nwapa Company to poblish ha buks an hep oda raiters. Shi tok sey wetin shi want na to tich people (espeshially wumen) abaut di rol of wumen for Nigeria – how dem dey survive, how dem relate wit dia hosband an pikin, an wetin dem believ for tradishon.

Even though at fest she no like di word "feminist" bikos shi feel sey e dey against men, leta shi gree sey wumen sopos get di sem chanz lik men.


Ha leta years an death

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Nwapa stil dey tich for difren universities hol ova di world, lik New York University, University of Minnesota, University of Michigan, an University of Ilorin. Shi tok sey shi lik to rait abaut how wumen dey struggle for a world wey men dey kontrol.

Shi die on 16 October 1993 for Enugu bikos of pneumonia, wen shi bi 62 years old. Ha last buk The Lake Goddess kom out afta shi don die.

Onyeka Nwelue do documentary "The House of Nwapa" to celebrate ha life.

Google uze her birthday do Google Doodle for 13 January 2017.

Ha pikin, Uzoma Gogo Nwakuche, opun Flora Nwapa Foundation for 1994 to kontinue ha wok.

Wia dem gada tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]