Fisheris and Climate Change

From Wikipedia

Di way klimet or weyda dey chenj dey hafet di way fish an oda wota hanima-dem dey produs for wota: Bikos weyda jos dey chenj enihow, e dey hafet di hasosiashon wey wota hanima get wit plant wey de inside big wota wey dem dey chop. Wetin dey korse dis one bi sey klimet chenj dey mek big big wota-dem dey hot pass norma, dey mek wota dey taste as if e sawa, an e dey ridus di "air" or hosijin wey de inside wota wey fish an oda wota hanima dey yuz. Klimet chenj stil dey hafet smol smol wota-dem like riva, pond, lakes, an wota wey de inside graund too.