Jump to content

Feminist Coalition

From Wikipedia

Feminist Coalition na grup of yong Naija feminist wuman dem wey dey wok to promot ikwoliti bitwin man and woman for Naija sosaiti.[1][2][3]

Damilola Odufuwa and Odunayo Eweniyi bi di two wumen wey fom di grup for July 2020.[1][4]

Projet wey dem don du

[chenj-am | chenj-am for orijin]

For October 2020, Naija pipul bigin du pisful protest against polis wahala. Di protest get slogan: “End SARS” - dem wan mek govment kansul SARS (Special Anti-Robbery Squad), wey bi one polis unit wey pipul say dey bit, arest and kpai inosent pipul.

Di Feminist Coalition disaid say dia fest big projet go bi to sopot di End SARS protest, mek pipul wey dey protest dey safe and fit yus dia human rait and mek dem no fis to yus am.[5][6]

For 12 March 2021, some Naija midia bigin tok say Feminist Coalition membas yus ₦23,000,000 (abaut $51,000) Bitcoin moni wey dem gada for End SARS and muv am enta dia private accounts.[7]

Bot di grup tok say dem no du laik dat. Dem riliz official statement plus evidens to show say dem no do enitin bad. Di evidens show nomba wey konsan crypto, bot plenti pipul no undastand am bikos crypto mata had to tel pipul.

Some crypto espats for Naija and abrod tok say di evidens no klia and e get plenti mistek insaid. Dem say e ivun kontradit wetin di grup tok bifo - laik hau dem fest say loyas dey wok for fri (pro-bono) durin di protest, but di evidens show say dem yus millions of naira pay for legal services.

Crypto pipul kom kritisaiz dem say dem haid trut and konfius pipul on purpose.

For May 2021, Feminist Coalition riliz one big audit ripot to klia di mata on hau dem yus moni wey dem gada for End SARS. Bot pipul stil kritisaiz dem bikos dem send di ripot onli to pipul wey donate di moni.

Pipul bigin ask kweshon: “If una say di donation na anonymous for 2020, how una tek no di email of pipul wey donate?”

Dis kontradishon mek pipul fil say di grup stil dey haid info and no dey klia wit hau dem yus moni.[8]

Wia dem gada di tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]
  1. 1 2 "In Nigeria, When Will Justice Catch Up With the Present?". 2020-10-27. Retrieved 2025-04-21.
  2. "End SARS Protest: Feminist Coalition say dem go continue to fight for Nigerian women". BBC News Pidgin. 2020-10-23. Retrieved 2025-04-21.
  3. "How to continue support for the End SARS movement in Nigeria". 2020-10-29. Retrieved 2025-04-21.
  4. "Odunayo Eweniyi and Damilola Odufuwa, Nigerian Allies to #EndSARS". Bloomberg. 2020-12-03. Retrieved 2025-04-21.
  5. "'We Are Able to Get Things Done.' Women Are at the Forefront of Nigeria's Police Brutality Protests". 2020-10-21. Archived from the original on 2020-11-09. Retrieved 2020-11-12.
  6. "How bitcoin powered the largest Nigerian protests in a generation". 2020-10-26. Retrieved 2025-04-21.
  7. "Twitter abuzz over withdrawal of '$51k worth of bitcoin' from #EndSARS funds by Feminist Coalition". TheCable. 2021-03-12. Retrieved 2025-04-21.
  8. "#EndSARS: Controversy trails feminist coalition's financial report". Latest Nigeria News, Nigerian Newspapers, Politics. 2021-05-08. Retrieved 2025-04-21.