Jump to content

Femi Ogunrombi

From Wikipedia

Femi Ogunrombi (e kpai for 14 January 2023) na Naija aktor an pesin wey de stodi muzik. Pipo no Ogunrombi as Papa Ajasco bikos of one komedi show wey e akt for Wale Adenuga. Di tahitu of di TV program na Papa Ajasco and Company. Na wen Abiodun Ayoyinka tok sey im no do again mek Wale Adenuga pik Ogunrombi mek e tek-ova

How im tek go skul

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Ogunrombi rid muzik an drama for Obafemi Awolowo Yunivasit. Wen Ogunrombi stil de Yunivasit, e fom one kwaya band wey e kol The Ayoro Voices. Dis kwaya grup leta get redio an TV program wey pipo dey lisin to on BCOS, OGTV , an NTA Ibadan. Dis grup get pipo like: Ayo Thomas, Jide Ogundipe, an Iyabo Omomeji. Dis The Ayoro Voices grup leta bikom di kolshora imeji for OAU in 1980 and 1983.

Steven Osazuwa tok sey:Na muzik bi di gift wey God give Femi Ogunrombi. E no bi like im broda but chenj from medikal go rid muzik for Yunivasiti of Ife. Na dia e form Ayori Voices.

How e tek work

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Ogunrombi join di Nashonal Troupe of Nigeria as dia muzik faciliator in 1994. E bikom di daretor of muzik an e kondot Nashonal Choir in 1998. Ogunrombi bi konsotat for Legos Stet Kansu for Arts and Culture 1n 1999 an di Ekiti Stet Kansu for Arts and Culture in 2014. Ogunrombi start to dey akt as Papa Ajasco for di Papa Ajasco and Company in 2006. As im dey akt as Papa Ajasco, e stil bi Coordinator of Studies for Adenuga PEFTI film Institute.

How im tek kpai

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Ogunrombi kpai on 14 January 2013. Wahala wan hapun wen Ogunrombi kpai bikos TV stashon an Niuz Pepa dey yuz di pishon of Richard Abiodun Ayoyinka as Ogunrombi. Ayoyinka kom leta mek one vidio to mek pipo no di difren.