Facebook

From Wikipedia

Facebook na intanet site wie pipul fit rait sometin about diasef, luk piksho of dia frend, send mesej an vidio yuzin dia fone or komputa. Na one Amerika tekinoloji kompini get am kol Meta Platforms.Na Mark Zuckerberg wit e oda frend wey de Harvard Kolej mek Facebook in 2004. Di nem of Mark Zuckerberg frend wey join am mek Facebook bi: Eduardo Saverin, Andrew McCollum, Dustin Moskovitz, an Chris Hughes. Na 2004 dey kreate Facebook. Di word Facebook kom from di komanmet wey Amerika Yunivasiti dey giv studet. Di fest pipul wey yuz Facebook na Harvard studet, but todey, meni Norta Amerika yunivasiti sef dey yuz Facebook. Sins 2006, enibodi wey don rish 13 years of age fit yuz Facebook. In December 2022,Facebook tok sey na 2.96 billion yuza yuz Facebook evri month an if dey sey mek dey chuz di websait wey pipo dey go pass for intanet, na Facebook bi nomba three.

In di 2010s, na Facebook pipo download for dia fone an komputa pass.