Jump to content

Eyo Festival

From Wikipedia
Eyo Festival
festival
Subclass ofcultural event Chenj-am
Inception1780 Chenj-am
KontriNaija Chenj-am
Indigenous toYoruba pipul Chenj-am
Located in the administrative territorial entityLagos State Chenj-am

Eyo Festival wey pipo no as Adamu Orisha Play na Yoruba festival wey dey hapun onli for Legos Stet, Naija. Dis festival still get smol histri with Iperu-Remo, one town wey de Ikenne lokal govamet, Ogun Stet. For dis awa time, pipo of Legos dey yuz Eyo festival as a festival to entaten forin pipo wey kom di kontri. Bikos of di histri of Eyo festival, pipo of Legos dey do di festival in Legos Island.

Di word Eyo mins a dansa wey put difren kloth wey bi like egunnu (masquerade) wey de kom out dorin di festival. Di orijin of Eyo festival dey link to di sikrit sosa-eti wey de Legos. Long time ago, pipo of Legos dey do Eyo festival wen dia Oba (king) kpai. Dem dey do Eyo festival to poshu di spirit of Oba wey don kpai an yuz di sem Eyo festival to welkom di niu Oba wey jus bi king.

Wen dem wan start di festival, pipo of Legos go klose road mek motor no pass for road ( dem go klose di road from Carter Bridge go rish Tinubu Square). Di risin for dis na mek di Eyo an pipo fit waka from Idumota Iga Idungan palas. Di white Eyo dey repiset di spirit of pipo wey don kpai. Yoruba pipo dey kol dis spirit agogoro Eyo (e miss tall Eyo) . Di fest Eyo festival hapun in Legos on 20 February 1854 to yuz am selibret di life of Oba Akitoye. Bifor bifor, Eyo festival na for na selibrashon of king-dem wey kpai an di seleshon of niu lida. Nowadays, dem dey do di festival to selibret big pesin wey kpai or big parti like wen oda presidet kom visit Legos.