Eugenia Abu
Eugenia Abu (wey dem bon as Eugenia Jummai Amodu for 19 October 1962) na Nigerian wey sabi broadcast journalism, shi dey rait, shi bi poet, an shi sabi media wok wel wel. Pipu sabi am wel as one of di beta nius pipu wey wok for Nigerian Television Authority (NTA) bifor. Shi bi news anchor wey dey read 9:00 pm niuz for NTA for seventeen years. Pipu dey ci am as one of di best broadcasters an event hosts wey Nigeria don get.
Earli life an Edukeshon
[chenj-am | chenj-am for orijin]Dem bon Eugenia for Kaduna for 1962. Shi stat to dey rait wen shi bi jos 7 years old. Shi tok sey ha papa an mama get big influence for ha life. Shi go ABU Staff School for Zaria, kom go Queen Amina College for Kaduna wia shi du ha secondary school. Shi go Ahmadu Bello University (ABU) Zaria go stodi English, an shi graduate for 1981. Shi still get Master’s Degree for Communication Policy Studies fom City, University of London, wey shi finish for 1992 wit distinction. She still get Graduate Certificate for Education fom ABU Zaria for 1981.
Wen shi dey ABU, shi bi di aktin editor for one English literary magazine wey dem kol Kuka for 1982, an shi even contest for Vice President for Student Union Government (SUG). Shi bi Chevening Scholar an USIS Fellow.
For 2018, shi opun one plez wey dem kol Eugenia Abu Media Center. Na plez wey shi dey uze hep yung pipu wey lik creativity an media wok. Di center dey run yearly creative an literary boot camp for pikin wey dey between 7–15 years.
Raiting an poetry
[chenj-am | chenj-am for orijin]Eugenia Abu na raita an poet. Ha buk In the Blink of an Eye win di ANA/NDDC Flora Nwapa Prize for best female writing for 2008. Shi stil rait one poetry collection wey dem kol Don’t Look at Me Like That.
==Wia dem gada tori