Jump to content

Emotan

From Wikipedia

Emotan (nobodi rimemba di date wey dem bon am but e live around 1440 go rish 1473) na one maket wuman wey dey sell food for oba maket in Benin kindom. Di wuman live for di time wey Oba Uwaifiokun an prince Ogun dey kontro Benin kindom. Prince Ogun leta chenj im nem to Oba Ewuare di Great wen im chenj from prince to Oba of Benin. Emotan bi di fest pesin wey start day care sarvis in Benin. Pipo dey tok sey na Emotan helep Oba Ewuare fit kom back kom sit down as Oba of Benin afta plenti years wen dem don poshue am komot from Benin.

How e tek start life

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Emotan ril nem na Uwaraye. Dem bon am bitwin 1380 an 1400. Wen Emotan hosband kpai, e go build one small bamboo hause. Emotan dey yuz dat bamboo hause dey tekia of smol smol pikin.

Emotan helep Ewuare to fit kolet di throne of Oba of Benin. Na Emotan tell Ewuare wetin Uwaifiokun an some shif dey plan to do to am, wen Ewuare stil de onda ban mek e no enta Benin. Emotan tell Ewuare sey na kill Uwaifiokun an di shif dey plan to do am. Ewuare leta give Emotan di taitu of Iyeki. (Iyeki for oyinbo langwej mins lida of Ekpate guild).

Di work of enibodi wey get di Iyeki taitu na mek im bi di pesin wey dey kontro maket an mek suo sey no sikio-riti strong wel wel

How pipo tek start to dey woship am

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Afta Emotan kpai, Oba Ewuare mek am god by givin orda mek dem plant holy Urine tree for di sem place wey Emotan dey put im foodstuff for maket. Oba Ewuare stil give orda sey evribodi go fest show respet to Emotan wen e wan selibret eni serimoni for Benin.

Wen two Uruhe tree fall down, dem kom mek one big emeji of Emotan for di maket place. Di emeji hi rish di levu of hu-man bein. Na John A. Danford mek di emeji an na Oba Akenzua ll opun di emeji mek evribodi kom see am. Dem join hand with British Colonial Authourities an na May 20, 1954 dem do am. Na for Oba Maket in Benin Siti, Edo Stet di emeji de.