Emem Inwang

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search

Emem Inwang na Naijá aktres an model wey im forma nem na Emem Udonquak. For October 18, 2014 Emem swin di 2014 Nollywood Movie Award (3rd edishon) for Best Aktres for soportin rol for di fim Itoro.Dat event wey e tek kolet di awod happun insaid Intakontinental Hotel, Legos.

Tori of e Life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dey bon Emem Inwang for September 8 an na Awka lbom stet e kom fom.Emem mari e hosband Moses Inyang on April 5, 2014. E hosband bi dareto an produsa of fims.Di marej produs two pikin an di fest pikin wey Emem bon na 2015 e bon am.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Emem popula wel wel as model wen e win di 2011/2012 Kalabar Karnival on December 23, 2011. Na First Bank of Nigeria dash dem moni to du di Karnival.Emem bi di ambassado an ofisiali tok tok pesin for pikin wey dia mama trowey for di sem year e win quin of Kalabar karnival.(na foma waif of Gofnor of Kross Riva stet Obioma Liyel-Imoke fom di Organisashion).Emem don akt in plenti fims.

Fims wey e akt[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Dr. Love (2020)
  • Itoro (2013)
  • Lock Down (2021)
  • Unroyal (2020)
  • Alter Ego (2017)
  • Crazy People (2018)

Awod[chenj-am | chenj-am for orijin]

Caption text
Awods Katigori Resot Ref
2014 Nollywood Movie Awards Best Actress in a soportin Role win
2014 Nollywood Movie Awards Nominated
2018 African Movie Viewers Choice Awards Best Soportin Aktress Nominated