Elma Mbadiwe
Elma Kenechukwu Mbadiwe na Naija aktres.
How shi stat life
[chenj-am | chenj-am for orijin]Dem bon Elma for 28 January 1988, for Imo State, Nigeria. From smol pikin taim, shi laik art wel wel, wey mek am sabi draw, akt, or du enitin wey bi abaut entatenment.
Edukeshon
[chenj-am | chenj-am for orijin]Mbadiwe go Redeemer's University for Ede, Osun State, wia shi stodi Mass Communication. Shi stil go len aktin for one speshial skul wey dem dey kol Royal Arts Academy for Surulere, Lagos.
How shi tek stat wok as aktress
[chenj-am | chenj-am for orijin]Bifor shi enta akting, Mbadiwe fest work as raiter for one media kompini wey dem dey kol Consolidated Media—na dem dey run SoundCity. Shi even folo wok for production team wey dey arenj how dem go sho tins for TV.
Ha aktin journey stat for 2016, an ha fest film na The Audition. But na wen shi akt as Talullah for Unbroken na im plenti pipu kom sabi ha wel wel bikos di fim mek sens. Shi stil play Laraba for E.V.E., an di two films na African Magic produs dem.
Shi don akt wit plenti Nollywood aktors for big fims lik Rattlesnake: The Ahanna Story and Dysfunction.