Ekwensu
Ekwensu na wayo wayo spirit of di Igbo pipo wey dey kos katakata. Na Ekwensu bi gods wey dey kontro how pipo dey bargain an stil bi di god of tortoise. Ekwensu sabi do wayo wayo for bizness an wey dem dey tok about price. Wen pipo wan go do bizness wey hard, dem dey pray for Ekwensu to helep dem. Pipo stil see Ekwensu as di spirit wey dey enta pipo to fight an kos katakata. Anoda god wey dey do like Ekwensu na Ogbunabili.
Evun sey meni pipo nowadays dey tok difren tins about am, Ekwensu no bi di devil.Na as Kristen rilijion dey popula wel wel, dis Kristen rilijion kom dey tok about di bad bad side of Ekwensu and stop to dey tok di good good side of dis god. Afta somtimes, pipo kom dey see Ekwensu as Devil (Satan). Di oyinbo pipo do evri-tin wey dem fit do to mek suo sey Igbo pipo see Ekwensu as Satan. Wetin Oyinbo get for mind na to put di Igbo pipo onda dia kontro an mek dem start to dey fear somtin.
Wen di Igbo pipo fest to dey woship dia god, Ekwensu bi one of di gods wey dem dey give respet pass.
Orijina Igbo pesin no dey see Ekwensu as a spirit wey dey do bad tins to human bein. In fat, Ekwensu bi di Igbo God of War wey dey lid woriho go fight war. Dis spirit get wayo wayo sense wel wel. Dis orijina Igbo pipo bilif in spirit wey get good mind or bad mind onli. Dem stil bilif sey wen pesin kpai, e dey go anoda wold to live anoda life.