Jump to content

Ekei Essien Oku

From Wikipedia

Ekei Essien Oku (22 January 1924 – 16 October 2004) na Nigerian librarian, historian, an raita. Shi bi one of di fest pipu wey get charter as librarian for Nigeria, an shi bi di fest wuman wey bi Chief Librarian for di kontri. how town tek fom for di 17th century.

Dem bon Oku for Calabar for January 1924. Shi go skul for Nigeria, an Queen's College for Lagos. Shi fest stat wok as ticha bifor shi stat wok as librarian. Dem leta send ha go London go stodi for North Western Polytechnic (wey dem don join insside University of North London now). Wen shi kom bak to Nigeria, Na shi bi di first Nigerian wuman wey bi chartered librarian for 1953. Di fest man wey get dis kain title bifor her na Kalu Chima Okorie for 1951. She later become di first woman wey be Chief Librarian for Nigeria for 1964, and she do di work for Calabar and Lagos.

Oku du research and write book wey dem call The Kings and Chiefs of Old Calabar (1785–1925), wey dem publish for 1989. She study wetin missionary dem write down, including di time wey slave dem revolt. She believe say even though slave dem want freedom, dem still support dia master dem. After dia master dem die, di slave dem wan justice or revenge for di people wey kill dem.


For year 2000, BBC do half-hour documentary about her life and work, dem call am African Perspective. Oku die on 16 October 2004, when she be 80 years old.

Wia dem gada tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]