Effect of climate change on oceans

From Wikipedia

Wetin Klimet (or weyda) wey dey chenj dey korse for big big wota-dem like Ocean or sea plenti wel wel. Dem bi:

  • Ocean dey hot pass bifor
  • Ocen hacid levu don go up.
  • di levu of wota wey de ocean don go up
  • Ice-blok wey de inside ocean wota dey melt kwik-kwik
  • Chenj in how dip ocean dip rish.
  • ridus di levu of Oxygen gas inside ocean.
  • chenj di way wota dey flow for ocean.

All dis chenj dey hafet livin tins wey de inside dos big wota-dem. Di tins wey dey korse dis tin na bikos di earth don dey hot pass as e bi bifor bikos of all di tins wey human-bi dey du. Ezampul of wetin human-bi dey du na to dey rilis one air wey oyinbo dey kol "Carbon dioxide" an anoda gas na " Methane". Bikos na di ocean dey kolet all dis gas wey man dey rilis inside di earth, dis one mek ocean wota dey hot pass bifor. Carbon dioxide gas fit bi hacid if e enta wota, dis one dey mek ocean wota hacid levu for ocean wota dey hi. Pipul tok sey ocean dey kolet 25% of carbon dioxide wey human-bi dey rilis to di sorandin. Evribodi no sey ocean get difren difren leya as di way one ples inside ocean dip pass anoda ples. As ocean tempurashon dey hi more more, dis one dey mek di pat of ocean wey near outside dey hot. Dis na bikos di breeze wey dey kom ocean dey hot more more.If ocean kolet di hot breeze wey dey kom from land, e go give land e own kul breeze Dis one wey difren leya of di ocean dey hot more more, e dey ridus how di ocean sopos kolet hot breeze wey dey kom from land an dis one dey mek land breeze sef dey hot more more sins ocean no gri kolet di breeze. If hot breeze dey enta ocean more more, e dey give heavi breeze wey dem dey kol "cyclones" more pawa. Dis heavi breeze an di oda ones wey dey skata tins go dey plenti more more bikos of klimet chenj. Di fud wey fish wey de nia on top ocean no go si fud chop again bikos na di more ocean kolet "carbon" for bodi, na di more fish go get fud to chop. As ocean tempurashon dey hot more more na so di levu of salt inside wota go inkres an na so smol wota like riva go dey get smol smol salt.

Wota wey don hot no fit get di sem levu of hosijin gas wey wota wey kulee or cold go get. Dis kulee wota dey get more hosijin pass hot wota. Sins klimet chenj dey mek ocean hot more more, hosinji wey fish wota nid to fit dey alive dey ridus an dis one dey mek some fish kpai an some fish fit go just waka go aria wey dem no sopos de if not bikos of klimet chenj.