Effect of climate change on human health

From Wikipedia

Di hafet of klimet chrnj on human-bi health dey hapun in two ways. Di fest one bi di daret one an di sekond way bi di indaret. For di daret hafet of klimet chenj, weyda no gi dey norma an dis one dey korse injuri an mek pesin kpai. Di indaret one bi sey klimet chenj go mek onga plenti bikos fud for farm no go gro wel wel an wota wey gud for drinkin for hard to get.

Di kind wahala wey klimet chenj dey korse for human-bi no bi smol tin. We fit puy di wahala into three katigori:

  1. daret hafet ( ezampul, hot weyda, bad weyda)
  2. di klimet chenj wey dey jafey oda tins wey dey helep man fit live ( fud prodorshon, moskito an fish for wota)
  3. di indiret hafet wey dey lid to povati, mek pipul no get ples to stey again, an menta health wahala.

Di fat bi sey, weyda wey too hot fit hafet pesin health in di folorin ways: e fit mek pipul wey no like hot aria stat to sik, mose fit mek di nomba of pipul wey dey kpai go up, e fit hafet fisika wok wey pipul dey do, an e fit korse menta probem for some pipul.

Klimet chenj fit korse mek some disis plenti pass norma. For ezampul, in some aria , disis wey moskito dey korse fit plenti, disis like kolera, an some disis wey dey hapun bikos pesin drink wota fit plenti. Klimet chenj fit