Effect of climate change

From Wikipedia

Wetin klimet chenj or weyda wey dey chenj for di wold dey korse plenti wel wel. Weyda wey dey chenj dey hafet envaromet, dey hafet how plant an hanimal dey sopot one anoda to fit live, an dey hafet human-bi sosaheti too. Di hafet of weyda wey jos dey chenj dey hafet diften aria pass oda aria in difren ways. For som aria, klimet chenj fit mek di aria hot pass nomal, an for oda aria e fit mek di aria kul pass nomal. We fit ridus di hafet of klimet chenj if we do tins wey fit stop di klimet chenj or we do tins to hajos wit di chenj.

Klimet chenj don damej meni land as e don mek di land hot pass nomal bikos of tempurashon wey jos dey high more more. Dis tempurashon wey dey go up don mek land no too get wota for graund ( too dry) an klimet chenj don also mek di way bush an forest dey kach faya plenti more more. Di way evriwie dey hot nowadaz don hafet how di nashora envaromet dey sopot livin tins wey de inside.

Bikos of klimet chenj, som kind of hanima wey dey inside wota dey komot from di aria of wota wey don ova hot for dem go aria wey stil dey kul for now. Hanima wey dey waka for land sef don dey komot go aria wey de up up bikos of klimet chenj. Di mata now bi sey, fish-dem wey de inside wota don dey enta inside wota wel wel dan bifor bikos di top of di wota don dey hot for dem to fit live nowadaz. Na bitwin 1% (pacent) an 50% (pacent) of hanima wey dey waka for land fit no dey again in fushor bikos of di hafet of klimet chenj.

Di hafet of dis klimet chenj on big wota like ocean bi sey: e dey mek ocean hot pass nomal, e dey mek ocean wota get hacid too much, e dey mek ocean wota ovaful, e dey mek ice block inside ocean dey mek kwik kwik, e dey chenj how dip ocean dip rish, e dey ridus di levu of osijin (oxygen) gas wey de inside ocean wota an e dey chenj di way wota sopos flo inside ocean.

Klimet chenj dey hafet fud prodoshon an dis one dey mek fud no too de like bifor. Wota wey klin wel wel sef no de like bifor bikos of klimet chenj. Klimet chenj don even hafet human-bi bodi bikos of di heat wey jos dey. Sins klimet chenj dey mek evriwie ova hot, dis one don mek sikness an disis plenti more more.

Di hafet of weyda wey jos dey chenj dey hafet difren kontri for difren ways. Kontri wey bi sey na dem dey rilis one gas kol carbon dioxide (C02) no too dey feel di hafet bikos dey get moni an tin-dem to fit hajos dan oda kontri wey no get dos tins.

Di bizness wey go sofa bikos of klimet chenj na: agrikolshor, fish bizness, fayawood bizness, bizness wey bi to give light or pawa, bizness wey bi sey na to mek pipul travu go enjoi demsef, bizness wey bi moni bizness. Som group like pipul wey no get moni, wuman-dem, smol pikin-dem an pipul wey dey stey for one patikula aria fit sofa di hafet of klimet chenj dan odas. Klimet chenj fit mek pipul komot for dia aria go oda aria bikos dey wan go fit fud as klimet chenj don hafet dia land wey dem dey yuz farm.