Effect of Climate Change on Ecosystem

From Wikipedia

Di way Weyda dey chenj dey hafet hanima wey de waka for graund an di one wey de inside wota, Oda tins wey di weyda wey de chenj evritime dey hafet na tundra, Mangroves, Koral reef an Caves. As evriwie just de hot, as sea level jost dey rise show sey we don dey see di efet of weyda wey just de chenj enihow. Bikos of weyda wey de chenj enihow, di one fit mek some plant or hanimal no dey again, mek di way hanima an plant dey tek kopurate no de again, mek we dey see some hanimal or plant for aria wey de no sopos de, mek forest no dey again, mek levu of hasid wey de sea an ocean go up, mek rain dey fall enihow an mek nashora katakata jost dey hapun.

Di full Tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di way weyda de chenj dey hafet evriwie wey we fit find livin tins. Di hol wold don dey hot pass bifor an dis one dey mek some hanima to komot from wey dem dey stey go oda Ples (some wey no fit go oda ples don kpai). One ezampul na how bird dey move abaut. Bikos di weyda dey hot more more, bird nid to go oda ples wey fit di kondishon wey de fit live. Bikos di weyda dey hot more more, snow no too dey fall like bifor again, di levul wey sea di rish don go up wel wel. Di tin wey dey kova di earth mek sunshine to too much wey Oyinbo dey kol "ozone" no too strong as bifor an weyda sef no bi like bifor. All dis tins fit hafet how man set dey du tins for the earth an how plant an hanima dey du tins togeda. From di IPCC Fourth Assessment Report, Pipul wey sabi weyda tins chenj litireshon buk on how weyda wey dey chenj dey hafet plant an hanima, tok sey inside di 30 years wey jos pass, wetin human bein dey du don dey hafet di earth an life wey de inside am. (Rosenzweig et al (2007) ) Schneider as oda pipul wey hep as tok sey di way evriwie dey hot more more don hafet some hanima an di relashoship bitwin plant an hanima. Dey even tok sey di wey weyda dey chenj more more go mek some hanima to kpai patapata an di nomba of difren difren hanima an plant go ridus wel wel for di wold.