Edwin Clark
Man abi wuman | man ![]() |
---|---|
Kontri wey e kom from | Naija ![]() |
Fest nem | Edwin ![]() |
Famili nem | Clark ![]() |
Wen dem bon am | 25 May 1927 ![]() |
Wen e kpai | 17 February 2025 ![]() |
Wok wey e dey du | politician ![]() |
Edwin Clark (dem bon am for May 25, 1927 and e kpai for Febuari 17, 2025), wey pipo also sabi as Edwin Kiagbodo Clark, na di Naija neshonalis, Ijaw neshonal lida an politishian.[1] E bin serve onda di govmet of di militiri govnor Samuel Ogbemudia an head of stet, General Yakubu Gowon bitwin 1966 an 1975.[1] For 1966, e bi wan of di pipul wey dia wok na to advais di militiri govnor of di Mid-Western Rijon provins, David Ejoor an dem mek am Federal Komishona of Infomeshon for 1975.[1]
Clark bi di advaisa wey no dey ofisha to Presido Goodluck Jonathan.[1] Na im bi di filantropis wey bin found di Edwin Clark Fandeshon and stat wan univasiti for im hometown for 2015.[1]
How e tek kpai
[chenj-am | chenj-am for orijin]Clark dai for Febuari 17, 2025, wen e dey 97 yies.[2]
Bifor bifor presido of Naija, Olusegun Obasanjo bin kol Clark im "ogbonge broda, padi, koret lawya an betalicious ekonomist".[3]
Di Naija pastor an blogga, Isaiah Ogedegbe bin kol Clark "pesin wey rili luv Naija an wey dem sabi for im bodnes and tru tok all di taim".[2]
Akordin to Ogedegbe, "Clark na di lida of di Ijaw nation wey im pipul dey respet wella, wey bi man of betacious karata, onyushua wisdum an upraitnes. Na im bi di man wey dey always ginja for di gud of im pipul-dem, an wey dey yuz im konshiens tek fait for dia raits".[2]
Dem also sabi Clark for im abiliti to always spik truth to pawa,[2] an e neva fia to tok abaut eni neshona mata or to mek pis.[4] Ogedegbe also bin menshon "im strong dedikeshon to di pipul".[5][6] As pesin wey pipul dey si as di "Papa of di Niger Delta Struggle", dem don kol Clark "a man wey fialesli fait wit diktetors an orye jayents".[5] Til today, pipul stil dey feel im influwens wella sake of sey im leave behind ogbonge legasi an laif-taim komitmet to di pis, stabiliti an progres of di Naija Delta rijon an indeed, Nigeria".[4]
Pej wey konsan dis one
[chenj-am | chenj-am for orijin]Wie dem gada di tori
[chenj-am | chenj-am for orijin]- ↑ 1.0 1.1 1.2 1.3 1.4 Ogedegbe, Isaiah (18 February 2025). "18 things to know about the late Ijaw leader Chief Edwin Clark". NewsExpress Nigeria. Archived from the original on 19 February 2025. Retrieved 1 March 2025.
- ↑ 2.0 2.1 2.2 2.3 Ogedegbe, Evelyn (20 February 2025). "Chief Edwin Clark Was A Patriotic Nigerian, Says Nigerian Cleric And Blogger". The Warri Times. Archived from the original on 20 February 2025. Retrieved 30 March 2025.
- ↑ Oyeweso, Femi (18 February 2025). "Obasanjo Mourns Edwin Clark, Says Late PANDEF Leader Was Accomplished Politician". Leadership News. Archived from the original on 18 February 2025. Retrieved 30 March 2025.
- ↑ 4.0 4.1 "SNYC Honours The Life of Edwin Kiagbodo Clark". The Nigerian Voice. 13 April 2025. Archived from the original on 13 April 2025. Retrieved 13 April 2025.
- ↑ 5.0 5.1 Godlives, Patrick O. (1 March 2025). "PA EDWIN CLARK: A LIFE OF SERVICE, POLITICS, AND ADVOCACY". Alexander Brown Hall Press. Archived from the original on 2 March 2025. Retrieved 30 March 2025.
- ↑ "Edwin Clark (25 May 1927 - 17 Feb.2025)". Peoples Daily Newspaper. 22 February 2025. Archived from the original on 26 February 2025. Retrieved 30 March 2025.