Edna Garrido Ramírez

From Wikipedia

Edna Garrido Ramírez (dey bon am June 19, 1913 an e kpai April 11, 2010) na Dominican wuman wey bi tisha, risasha an pesin wey dey stock an rekod how dem dey du tins for lokal way. Pipul sabi am as one of di pipul wey stat to dey rekod Dominican lokal dans, tok, song, pikin games an odas lokal tins an how difren siren kolsho dey mek muzik an how e dey du pipul wey dey lisin to am.

How e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Azua, Dominika Ripoblik dey bon Edna Garrido Ramirez in 1913. Garrido famili-dem na raita. E gro up in San Juan de la Maguana. Garrido papa nem na Victor Garrido Puello an e mama nem na Tijides Ramírez Lasala. Garrido papa na raita, jornalist, an pesin wey dey rait histri an e mama na di pikin of jeneral Wenceslao Ramirez. Garrido du e pamari skul in San Juan de la Maguana. Afta wen e don rish ten year old, e join e famili as dey pak go di kapita of Dominika Riploblik Santo Domingo. E go Institute de Señoritas Salomé Ureña go rid edukeshon an e finish di skul in 1934. Garrido wok as Trisha from 1934 go rish 1946. Garrido bi klose padi of Hilma Contreras. Na Hilma Contreras win di 2002 Nashonal Litirasho Prize awod. Bikos of di advais wey e frend tel am, e join di klass wey Amerika professor Ralph Boggs dey tek in Autonomous Yunivasiti of Santo Domingo in 1944. Dat klass wey e join mek e luv for how to dey rekod how pipul dey du tins for lokal way gro. E waka all di kontri as e dey du risach. Garrido du risach on South nails de Palo an La Cofradia del Espiritu Santo. E travul go Cibao rijion wia e kolet di rekod of popular lokal singa Ñico Lora.