Eddie Ugbomah

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search

Eddie Ugbomah (dem bon am December 19, 1940 an e kpai for May 11, 2019) na bifo bifo Naija fim dareto an produsa. Na im daret and produs fim The Rise and Fall of Oyenusi in 1979, The Boy is Good an Apalara. Apalara na fim wey tok abaut di life tori of Alfa Apalara for Oko Awo, Lagos. Most of e fim na wetin dey happun for life like The Rise and Fall of Oyenusi wey tok abaut di bad tiff, Ishola Oyenusi.

Tori of e life an wok wey e du[chenj-am | chenj-am for orijin]

Ugbomah papa kom fom Ashaka Vilej aria for Aboh in East Ndokwa lokal Govament in Delta Stet but na for Obalende an Lafiaji aria of Lagos e tey du e smol pikin.E go St Matthias, Lafiaji, Lagos an City College school.Leta, Ughomah traful go London for e haya edukashion wey e go rid tins abaut Niuz, drama an fims dem. Afta e finish, Ughomah wok wit BBC an e du smol rol inside Dr.No, Guns at Batasi an Sharpeville Massacre. Ughomah bi memba of one Afro-Caribbian drama grup an e daret som of di grup pla like This is Our Chance an na for Stoke Newington Theatre Hall dey du di pla.Ughomah kom bak to Naijá for 1975.Wen e kom bak to Naijá,E du sho promoshion bifor e stat ' Edifosa wey bi fim produkshon kompani.Ugbomah fim dey tok abaut tins wey dey happun for life an Politiks. For 1979, e produs Dr Oyenusi dat fim dey fim tok abaut di notorious robber is Isola Oyenusi wey terrorize Lagosians in di early 1970's. Di fim also tok abaut armed robbery for Naija. For di fim "Oyenusi" Ugbomah feature as di lead aktor. Ugbomah release i next fim, "The Mask" for 1979. Di fim tok abaut di histori of Naija during di Benin Expedition of 1897 and how dem take tiff artifacts from di Benin palace. For di fim Ugbomah play di rol of Obi wey try to secretly tiff di Benin ivory mask and return am to Naija. Some pipu link di character of Obi to di MI6 agent James Bond.Ugbomah karia flourished into di early 1980s, I produce fim like Oil Doom, Bolus '80 and The Boy is Good. Dem shot Most of i fim with 16mm with di exception of The Mask. Later for i karia Ugbomah turned to Yoruba video fim. For 1988, Dem appoint am as di chairman of di Nigerian Film Corporation. Ugbomah kpai for 11 May 2019, for di age of 78.

Fim wey i dey[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • America or Die (1996)
  • Toriade (1989)
  • The Great Attempt (1988)
  • Omiran (1986)
  • Apalara (1986)
  • Esan (1985)
  • Death of a Black President (1984)
  • Vengeance of the Cult (1984)
  • The Boy is Good (1982)
  • Bolus '80 (1982)
  • Oil Doom (1980)
  • The Mask (1979)
  • Rise and Fall of Oyenusi (1977)

Wie dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]