Jump to content

Ebun Joseph

From Wikipedia

Ebun Joseph Arogundade (wey dem bon am for 1970) na Nigerian-Irish lecturer, raita, an consultant. Na shi bi di pesin wey stat di first Black Studies module for Ireland inside University College Dublin (UCD), an shi stil dey in charj of am.

Wetin shi don Do

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Ebun Joseph fest go school to len microbiology for University of Benin. Afta dat, shi wok as Administrative Secretary for di Nigerian Britain Association bifor shi komot go Ireland for 2002. Shi do master’s digre for edukeshon, Adult Guidance an Counselling for Maynooth University. Shi leta get PhD for Equality Studies fom di UCD School of Social Justice. Shi don tich for Trinity College Dublin an University College Dublin (UCD). For UCD, shi bi lecturer wey dey tich abaut social policy, equality, migration, an race. Na shi fest stat di Black Studies module for Ireland, wey shi du for 2019 wit Prof Kathleen Lynch. Shi stil bi di direkto of di Institute of Antiracism an Black Studies. Apat fom tiching, shi sabi wok as career-development specialist. Shi dey hep pipu plan dia career for di Royal College of Surgeons in Ireland an shi stil bi race relations consultant. Shi dey tich diversity training courses sef. Joseph na di chairpesin an di pesin wey stat di African Scholars Association Ireland (AfSAI). Na Shi stat The Unforgettable Women’s Network (TUWN) an shi bi one of di pipu wey stat di African Women Writers Ireland. Shi dey rait for African Voice niuspaper. Shi don tok abaut di racism wey shi don fez for Ireland an di one wey oda minority grups, lik di Travelling community, dey fez. Shi dey faight mek dem stop di Direct Provision system wey dem dey uze for asylum seekers for Ireland. Shi don tok sey di Black Lives Matter movement sopos get strong ground for Ireland. For 2020, wen meni pipu dey protest sey racism no gud, shi tok sey di faight sey racism no gud sopos stat fom hauz, an sey edukeshon dey veri important for di mata. Shi tok sey di Irish edukeshon system sopos add anti-racism topics insaide dia curriculum an sey dem nid put more Blak tichars for skul. Shi don share stories of yung Black Irish pipu wey don fez racism for dia skul. She don tok about di racism wey shi don fez for Ireland, plus one taime wey pesin open fake Twitter account uze ha nem du racist joke. She don arenj meni online town hall meetings wey bring Black lecturers, raiters an oda pipu togeda to tok abaut racism for Ireland. Shi don stil tok abaut how COVID-19 pandemic afet Black pipu an pipu of ey get difren colour wey dey wok for Ireland. For 2020, Joseph sopot di dicishon wey di Shelbourne Hotel tek to komot four statues of African women wey dem say be slaves from dia hotel front. Shi tok sey plenti Black pipu no even sabi say di statues dey dia, bikos dem no fit pay to go for di hotel. Shi don tok abaut di international muvement wey dey remuv statues of pipu wey sopot or gain fom slave trade. But for September 2020, one art historian, Professor Paula Murphy, chek di statues an sey dem no bi slaves.

Her pasonal life

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Ebun Joseph Arogundade na Benin City, Nigeria dem bon am for 1970. Ha papa, Chief Arogundade fom Okpe, na politician an former komissioner for edukeshon an finance. Shi get six brodas an sistas. Shi get two sons an shi dey liv for Dublin. Shi get Nigerian an Irish citizenship.

Som of di buks wey shi don rait

[chenj-am | chenj-am for orijin]

.Critical race theory and inequality in the labour market: Racial stratification in Ireland (2020) .Becoming Unforgettable: Uncovering the Essence of the Woman (2012) .Trapped: Prison without Walls (2013) .The centrality of race and whiteness in the Irish labour market – Irish Network Against Racism .Composite counterstorytelling as a technique for challenging ambivalence about race and racism in the labour market in Ireland – Irish Journal of Sociology (2020) .Discrimination against credentials in Black bodies: counterstories of the characteristic labour market experiences of migrants in Ireland – British Journal of Guidance & Counselling (2019) .Whiteness and racism: Examining the racial order in Ireland – Irish Journal of Sociology (2018).

Wia dem gada tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]