Jump to content

Deyemi Okanlawo

From Wikipedia

Deyemi Okanlawo (dem bon am 19 April 1981) na Naija fim aktor. Pipo sabi Okanlawo as aktor wey get talet wel wel for Naija fim indostrie. Akordin to wetin Film One Box Office report , na fim wey Okanlawo de inside sell pass for di kontri in di year 2020 an 2021.

How im tek stat life

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Legos dem bon Deyemi Okanlawo. E papa nem na Adeyemo Okanlawo an im mama nem na Adeyinka Okanlawo. E papa Adeyemo Okanlawo na enjiniha wey dey ripiyee eroplean an e mama sabi do kaki, bread an sabi do bizness. Okanlawo go Taikenny Nosiri an Pamari skul bifor e kom enta Intanashonal Skul , Legos. Okanlawo get Bashelor Digree (B.sc) in Kemikal Enjinerin from Yunivasiti of Legos. Okanlawo stil get satifiket in Aktin from Delyork Creative Academy.

How im tek wok

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na wen Okanlawo de five years im don start to dey akt fim. E start wen e dey do skul aktin. Wen Okanlawo de nine year, e join do one TV advatismet wey aktis wey get levu de inside. Di nem of dos aktis na: Kunle Bamtefa an Sola Sobowale. Wen Okanlawo de Yunivasiti, e dey put bodi dey join for drama group wey de di Yunivasiti. Afta im don finish Yunivasiti, Okanlawo wok as pesin wey dey sell an dey Ezekutiv Maketa in some indostrie like FMCG. Okanlawo akt inside in fest fim in 2011 an di nem of di fim na ZR-7: The Red House Seven. Na dat sem year e akt inside one smol fim wey get di tahitu: A Grain of Wheat.

Di way Okanlawo akt inside all dis smol smol fim-dem like: Gidi Up, Blink, an Knock Knock mek am popula wel wel. By di time wey 2012 wan rish, Okanlawo don bikom selebriti for Naija fimindostrie.