Deutsches Rechtswoerterbuch

Deutsches Rechtswörterbuch (DRW) na dictionari for legal wod. Na di Heidelberg Academy of Sciences and Humanities dey run am wen dem fest carri di wod for head for 1897. As we dey talk so, dem don get 104,043 artiku for di dictionari. Dem artiku take start for Aachenfahrt wey mean waka go Aachen, di wod wey dem dey naw na ubergehen wey mean say make persin commot eye. All di dem 14 volume wey dem don publish dey for paper and online. As per say di kain legal wod wey di DRW dey run na wod wey don dey before 1897, na why dem dey language like Old English, and latin dey show face sometimes for the dictionari. Dem plan finish am for 2036.
WETIN DEM DEY TRY DO
[chenj-am | chenj-am for orijin]DRW wan kova german legal wod for dem middle age reach dem early 1800s. Make we clear am, if we dey yarn legal mata, e mean say all dose stori wey dey yarn about law. Di pipu wey dey work for dis DRW wan make we sabi how dis kain wod dey show face for hood everyday. As dem dey run dis mata for DRW, dem talk say no be only wod for di normal language for Germani dem dey put for inside the dictionari, bet also wod wey dey for dem soso language and area wey dey follow Germani roll. For England, Transylvania, Lorraine even for dem Baltic wata. To talk am as Richard von Weizsäcker, one president for Germani talk that time,
“Di Rechtswörterbuch pour language and kulshure for inside stori like person wey pour sugar for garri, na why the wok wey dem dey do for that insititut dey gidigba.”
STORI STORI
[chenj-am | chenj-am for orijin]Na for 1896/97 dem first start di DRW for Royal Prussian Academy of Science. Na for dis time also oda dictionari mata like Schweizerisches Idiotikon take start. E be like say di Dictionari for Anglo-Norman Legal Wod wey di pipu for Selden Society wan do da year na wetin give dem DRW liver wey dem take start deir own (da Seldon dictionari na for legal wod for Fransais, but till today dem never show im face for outside). Na di dem“Na we dey dere” for Germani da time like Heinrich Brunner, Ernst Dümmler and Karl Weinhold, dey for the start of the wok. Otto von Gierke sef dey, and as per say na guru for Germani tori na why e reason say make dem add dem langwej for West Germani too. Since da time wey Prof. Dr. iur. Richard Schröder, wey be first oga for research don carry him Office go Hidelberg, na since den di Iinstitut don dey for Heidelberg. After Schroeder commot, Prof. Eberhard Freiherr von Künßberg follow take im place. Bet as per say Eberhard marri Jew, he gats japa go Amerika wit him waif for wartime. All dis waka waka show for di institut body and e too affect dem for Nazi rule and for start of World War II.. As Germani take divide, na so the Prussian Akademi (wey dem dey call Academy for Science for Berlin) take divide too, dem come carry di DRW com di Akademi wey dey Hidelberg for 1959. As forti years don pass, Dr. Heino Speer, wey be oga of research before before, come start to trow di tin for internet, make pipu fit get access. Dem no charge money.
HOW DEM TAKE DEY RUN AM
[chenj-am | chenj-am for orijin]All di dem artiku wey dey dere na for wan specific wod for Germani. E com get linguistic information about da wod and how dem dey take use am for inside law mata. All di meaning wey dey na evidence from di original langwej wey di DRW get for deir sources. Na so so quotations over 2 milla wey dem go gada for when di institut bin take start da time di DRW dey use for deir sources today.
Di evidence wey ol pass for di dictionari na from 479 AD, dem commot am for one Merovingian Charter for di time of Clovis I.. Di wod wey dem dey yarn about na mundburt (e mean protection right for one kain oga). For Felix Liebermann book Die Gesetze der Angelsachsen, evidence dey for di word mundbyrd (685/86). So dem text wey don tey for English plenty for di old source wey DRW dey use.
DRW don do some runz wey person gatz follow before dem go put di dem wod wey get anoda wod for side (compound) and simple wods for di articles. For wod wey carri anoda wod, di wod no suppose pass di 18 century time. Bet before one simple wod fit enter di dictionari, di first evidence wey show say di wod dey gatz no pass 1815. Dem no go print dem wod wey show face for arand 1815 to1835 for book, but e go dey online with one kain small reference.
DEM SOURCE FOR ENGLISH
[chenj-am | chenj-am for orijin]Liebermann book Die Gesetze der Angelsachsen (wey mean The Law for dem Anglo-Saxons) dey important sotey for DRW wen e reach Old English mata. Di book gada all di dem law wey dem Anglo-Saxon chairman don yarn for tey 5 century, and till naw sef pipu still dey call am ‘authoritative’ and ‘unsurpassed’ for di field. E get time, wey dem dey talk Old English for di dictionari, dem dey carry hand go di important Anglo-Saxon Dictionary wey Bosworth and Toller write sef.
Plenti document for legal mata wey be about di Hanseatic League and dia Stahlhof (Steelyard) for London fit also sweet dem English user for body.
Wen dem Germani pipu fom dem Rhine Franconian area waka go North America for di 17 and 18 century, dem kip dia dialekt wey pipu today sabi as Pennsylvania German (or ‘Pennsylvania Dutch’). Na why wod wey come from Pennsylvania German too dey enter DRW, example: freiheitsbâm > Freiheitsbaum (tree wey dey free persin), wey according to Lambert Dictionary of non-English Words of Pennsylvania-German dialect mean black poplar
Dem Reference
[chenj-am | chenj-am for orijin]- German quote via http://www.rzuser.uni-heidelberg.de/~cd2/drw/presse.htm
- Klaus-Peter Schroeder, Eberhard Freiherr von Künßberg (1881–1941), in: Andreas Deutsch (ed.), Das Deutsche Rechtswörterbuch – Perspektiven, Heidelberg 2010, p. 54f. and 58.
- Book description by Cambridge University press via https://web.archive.org/web/20160424093128/http://ebooks.cambridge.org/ebook.jsf?bid=CBO9781316225141