Demi Isaac Oviawe

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search
Demi Isaac Oviawe
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Nem for lokal langwejDemi Isaac Oviawe Chenj-am
Orijina nemDemi Isaac Oviawe Chenj-am
Wen dem bon am2 November 2000 Chenj-am
Ples wey dem bon amBenin City Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej Chenj-am
Wok wey e dey dufilm actor Chenj-am
Eye kolorbrown Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am
Personal pronounL484 Chenj-am

Demi Isaac Oviawe (dem bon am November 2 2000)na Nigerian-bon Irish aktres. Pipu sabi ha for di role wey shi akt as Linda Walsh for 2018 RÌÉ/BBC komdi siries The Young Offenders. For 2017 di Irish Examiners wey ha nem na Oviawe as one of their annual "ones to watch for 2018". Shi appear for 2019 series of di Irish edition of Dancing with the stars. Shi komot for di competishon February 17 an na shi bi di fes celibriti wey dem vote komot.

     ≈≈ Tori Abaut Ha Life≈≈

Oviawe dem bon ha for Benin city an shi muv kom Ireland wen shi bi two years old an shi gro op for county cork town of Mallow. Oviawe papa an mama wey their nem na joy an Joe given their dauta to one aktres nem Demi Moore. Dem get tu meni pikin as dem go Ireland. Oviawe mama die wen shi bi 5years an di papa die wen shi bi 15years. Boat of dem na cancer kill dem. Shi an ha two broda dem na their Irish stepmoda wey ha nem na Kim Carroll tek care of dem an shi bon two pikin man fo dia late papa an dia papa broda wey im nem na courage follow tek care of dem. Oviawe go mallow N01 Nashonal skul an den Davis kollege finish ha leaving cert fo 2019. Shi sabi se shi gud for aktin wen shi pla di rol as Mary for di skul Nativity play. latta shi akt for Camogie an Gaelic football an Starr for skul producshon of Beauty an the Beast,Grease an sister Akt. Bifo oviawe get plan ṣe shi go, go for trenin as sekondari skul tisha .Bot for 2017 shi go for audishon for YouTube for one rol for TV siries "The young offenders" an shi win di rol of "linda Walsh"

 Televishon
Caption text
Year Taitu Rol Notes
2018-2020 The Young Offenders Linda walsh 10episodes[11]
2019 Dancing with the stars(Ireland) Herself Contestant
TBA Holding Aoif
  ≈Fims≈
Caption text
Year Taitu Rol Notes
2020 To All Mia Darling Adaeze Short [12]
2022 The School For Good and Evil Anadil post-producshon,diaret-to-streaming Fim[13]