Daniel Etim Effiong
| Man abi wuman | man |
|---|---|
| Kontri wey e kom from | Naija |
| Fest nem | Daniel |
| Ples wey dem bon am | Kaduna |
| Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tok | English langwej |
| Wok wey e dey du | actor, film director, chemical engineer, screenwriter |
| Pat of wok wey e put mind | theater arts |
| Wie e go skul | Federal University of Technology Minna, University of Johannesburg |
| Academic degree | bachelor's degree |
| Hair kolor | black hair |
| Eye kolor | brown |
| Personal pronoun | L485 |
Daniel Etim Effiong wey pipo sabi wel wel as Daniel Etim-Effiong na one Naija aktor an fim daretor.
How im tek start life an go skul
[chenj-am | chenj-am for orijin]Na for Jaji wey de Kaduna Stet, Naija dem tek bon Effiong. Effiong don live in Benin Siti, wey de Edo Stet, e don live for Legos Stet, an also Abuja. Effiong papa na forma Lt. Col. Moses Effiong de among di pipo wey forma presidor Muhammadu Buhari fo-give for di Vaste Coup. Di Coup hapun in 1986 an na five pipo Buhari fo-give an rilis for prisin in 1993 bikos of dat Coup wey no soseed. Na like dat Effiong papa tek lose im rank as Col. for Harmi. Effiong go Mary Private School wey de Legos Hi-land. E go Government College wey de Ikorodu, Legos. Effiong rid Kemika Enjinerin from di Fediral Yunivasiti of Teknoloji, Minna, wey de Niger Stet. Wen e don wok smol in di oil and gas, e chenj im mind an go stodi fim-mekin, raitin an daretin at AFDA Film School wey de South Africa. Effiong stil go do fim-mekin korse for Yunivasiti of Johannesburg.
How im tek wok
[chenj-am | chenj-am for orijin]In 2017, Effiong daret one five-minit smol vidio wey get di tahitu Prey. Na im wife Toyosi produs di fim jos wen dem mari. Di fim get Hatist like: Tope Tedela an Odenike Odetola.
Bland2Glam in 2019 kol Effiong to join am akt in di #thePowerof7 kampain as im selibret Seven years wey dem don dey do fashion. Effiong de inside di 2019 komedi fim Plan B wey e akt di part of Dele Coker. Inside di fim, Dele Coker na one Naija CEO of one Nairobi kompini. Anoda Hatist-dem wey folo akt inside di fim two Kenya Hatist: Sarah Hassan an Catherine Kamau Karanja. Dis fim Plan B mek Effiong nem de di list of Best Actor in a Comedy (Movie/TV Series) katigori at di 7th AMVCA aword 2020. Effiong kom start to dey sho for meni fims in 2020. E evun bi di lid aktor in Fish Bone wey Editi Effiong produs. Oda Hatist wey folo join do Fish Bone inklude Shaffy Bello an Moshood Fattah. Effiong stil folo de for di smol fim Storm wey Diane Russet produs an Michael 'AMA Psalmist' Akinrogunde daret. Anoda Hatist wey folo join akt di fim Storm na Ike Onyeka an Atteh 'SirDee' Daniel.
Stil inside di year 2020, Effiong daret one dokumenteshon fim wey e kol Skin. Na Beverly Naya produs di fim Skin an Netflix wan dey sho am.
E pasonal life
[chenj-am | chenj-am for orijin]Effiong mari Toyosi Etim-Effiong on 4 November 2017. Effiong fest see Toyosi wen im dey try to get one projet. Di marej produs one gel-pikin in January 2019.
=How e tek wok
[chenj-am | chenj-am for orijin]Afta Effiong liv di Oil and Gas job, e kom dey produs smol smol vidio for NdaniTV