Daniel Abibi

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search
Daniel Abibi
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromRepublic of the Congo Chenj-am
Fest nemDaniel Chenj-am
Wen dem bon am1942 Chenj-am
Wok wey e dey dumathematician, diplomat, profeso Chenj-am
Post wey e deyMember of the Senate of the Republic of the Congo Chenj-am
Party wey e dey for politisCongolese Party of Labour Chenj-am

Daniel Abibi (Dem bon am for di year 1942) na Congo politishian wey no Matimatiiki an e go skul wel well. For di year wey bi 1980s, Abibi wok for gofment for Congo-Brazzaville as di oga pata-pata for di pipul wey dey du announsiment to di hol kontri an as di oga pata-pata for sekondri an big-big skul. Afta dis one, in di 1990s, e kom bi di pesin wey dey stand for Congo pipul for United Nations.

Tori of e laif an e wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Abibi get e Ph.D in matimatiks fom Univasiti of Grenoble wey dey France in 1970. E folo for di fest pipul wey kom frlom Sentra Afrika wey get dis kain big pepa for matimatiks. Abibi folo for di pipul wey dey rili du politis wel-wel wey kom fom north side wey stil go skul for France. Dem mek suo sey dem sopot Marien Ngouabi for di Congolese Students Association (AEC) for 1972. Dis kain join-bodi bitwin AEC an di gofment rili mek som pipul vex and dem no gree suport di Congolese Party of Labour (PCT). Di oga dem for di PCT kom kari Abibi by force go hide for wia pipul no go no. Dis one kom mek Ngouabi vex sey mek dem riliz am sharp-sharp.

For politis mata, Abibi rili sopot di Marxist idiya wey tok sey mek pipul for Afrika dey du tins wey go favor dem wel wel. E still wok as di oga pata-pata for one big skul wey dem dey kol Marien Ngouabi Univasiti. E kom bi pesin wey Denis Sassou Nguesso trust wel wel (e dey sopot enitin wey go favor Sassou).For 1983, dem kom dey kol am di oga pata-pata for pipul wey dey tell di pipul wetin dem nid to dey hear an tins wey dem go dey tell everibodi even if na far-far ples you dey liv. Dem komot di forma oga pata-pata wey e nem na captain Florent Ntsiba for día kom put Abibi as di oga pata-pata. Dem come still chenj am as di oga pata-pata for di pipul wey go dey tell di hol kontri enitin dem nid to hear.Dem kom mek Abibi di oga pata-pata for sekondri an big-big skul for 1984. As dem kom arenj evritin bak for 1986, Abibi no kom du dis wok again.

Abibi kom bi di oga pata-pata for di pipul wey no dey sopot one kain bilif sey som pipul beta pass anoda pipul. Di nem na Congolese Anti-Apartheid Committee an for 1989 dem kom mek am di oga pata-pata for dis kain tin for di hol Afrika. For dat sem 1989, dem put am join di PCT Politburo an dem tell am to dey tish pipul buk mata, plenti plenti tins, politis mata an mata wey go mek pipul no wetin dem sopos dey du an no du for dia kontri.

For di year wey bi 1990s, e kom join Pan-African Union for Social Democracy wey Pascal Lissouba bi di oga pata-pata. E stil wok as di pesin wey dey stand for di Congo pipul for United Nations for dis ten years.

Afta di Congo pipul don fight demself finish for October 1997 wey dem komot Lissouba an Sassou Nguesso kom begin rul again, Abibi komot hand for politis mata for Congo for meni years. E kom stil join Sassou Nguesso grup wey be PCT. For October 2011, dem chuz am mek e dey among di pipul wey dey bring di rul wey evribodi for Congo go folo, na Senate of Congo-Brazzaville bi di nem. E join dem wen e dey wit PCT grup for Sangha Department. Wen dem dey chuz who and who go be di oga dem for Senate side, 61 pipu for Sangha chuz Abibi, na 87.14% of everibodi wey chuz who and who dem want mek e bí día oga dem. Dis one rili favor Abibi wel-wel, e kom mek win fest an kom stil mek am join one of di six post wey dey for Sangha.