Dami Olonisakin
Dami "Oloni" Olonisakin (dem bon am on 6 August 1990) na British-Nigerian wey sabi tich pipul abaut sex mata an relationship wahala. Shi get blog wey shi dey kol Simply Oloni an shi dey run podcast too. In 2019, OkayAfrica put her nem for dia list of 100 strong wumen dem.
Ha life stori
[chenj-am | chenj-am for orijin]Olonisakin don liv for United Kingdom. Shi gro inside Nigerian famili wey dey do Christian. Shi get one younga sista. Wen shi dey smol , dem no rili tich ha beta sex edukeshon. Shi go University of Bedfordshire wia shi stodi journalism an shi kolet digre wit honours.
Ha wok for media
[chenj-am | chenj-am for orijin]Simply Oloni blog
Shi stat her blog Simply Oloni for 2008 wen shi bi 18 years old. Shi fest rait blog post bikos shi hear one chorch preaching wey dey against abortion, and e no too get meanin to ha. She tok sey:
- "E be like say dis message no koret. Dem sopos tich us sey, if person wan do sex, how we fit du am wel...e afet me wen I wan to dey rait abaut sex.
She jos dey rait abaut ha an ha frends' dating laife. But wen shi stat dey ansa ha readers for her blog, na dat taime ha platform rili stat. Ha readers dey ask questions wey nobody sabi who ask dem. Som of ha ansa shot, but som shi go chenj dem to full article. Simply Oloni dey talk abaut meni topics, lik how pesin go gree for sex , dating, sickness wey pesin fit kari for sex (STIs), abortion, wen pesin fors anoda pesin for sex, an how wuman fit enjoi sex. Di blog dey sopot mek pipu ci sex as beta tin.
Olonisakin wan fil di spas of advise abaut sex an relationship wey concern Black wumen. She talk say: "I notice say as Blak wuman an white wuman dey do dating an casual sex difren. Black wumen no too dey tok abaut sex, but e no mean say we no dey do am." Sho don stil tok abaut racism wey dey inside UK sex industri.
Oda wok
[chenj-am | chenj-am for orijin]Oloni get Twitter account, an shi dey encourage wumen mek dem share dia experience, shi go stat wit "Ladies". Shi get one podcast wey dem kol Laid Bare, wia shi an two oda Black wumen, Shakira Scott and Shani Jamilah, dey tok abaut dia own sex laif, giv advise to pipu wey dey listen, an gist abaut wetin dey hapun for di world. Dem dey encourej wumen mek dem enjoi sex. Most of di pipu wey dey listen na wumen of color.
Oloni dey giv relationship advis for BBC Three show My Mate’s a Bad Date. Di sho dey hep pipu wey no sabi date wel mek dem impruv.
Shi don stil do sex edukeshon workshop for secondary school, where shi dey tich abaut consent—how pesin go gree bifor sex go hapun.
Awords an recognition
[chenj-am | chenj-am for orijin]- Oloni blog Simply Oloni win 2015 Sex & Relationships Cosmopolitan Blog Award.
- For My Mate’s a Bad Date, she win 2020 Royal Television Society Midlands Awards for Breakthrough (On Screen) an On Screen Personality.
- In 2019, OkayAfrica put her name for their 100 Women list, and BBC 100 Women recognize her as Girl’s Champion.