Dadasare Abdullahi
Maimuna Dada-Sare Abdullahi MON (1918–1984) na Nigerian Raita, nors, ticha, an journalist wey bi Fulani pikin. Di love wey shi get wit Rupert East, one British raita an educationist, stat big palava bikos e chalenj wetin pipul for Colonial Northern Nigeria bliiv abaut kolsho an society.
Life
[chenj-am | chenj-am for orijin]Dadasare (wey mean "wife" or "mama for house" for Fulfulde) kom fom one beta famili for Gola, Bajama aria for Adamawa. Wen shi stil bi smol pikin, ha famili waka go Jambutu, stil for Adamawa. For ha buk It Can Now Be Told, shi tok sey wen shi dey smol swit wel-wel bifor dem kari ha go by fors.
How dem kari am go kip
[chenj-am | chenj-am for orijin]For 1929, as shi folo one famili memba travu go Gola, one British colonial ofisa wey wan get smol Fulani girl plan wit her cousin tek kari am go kip. Shi bi jos 11 years dat taime. Di ofisa kari three smol Fulani girls stand, kom pick Dadasare from dem.
Wetin Shi Do to Run
[chenj-am | chenj-am for orijin]For Jambutu, ha famili vex wel-wel, dem even wan faight to sav ha, but som elders tok mek dem fest trai beg di ofisa. Di colonial govment for Yola do investigation, kom ask Dadasare if shi wan go house bak. Shi tok meni taimes sey shi wan go meet ha mama, but dem still fors her mek shi stay wit di man.
One day, wen di guards dey sleep, shi trai run. Shi waka go bush dey find road go Jambutu, but polis leta katch ha kon return am bak. Bikos shi trai run, di colonial govment remuv ha uncle wey be di district head of Gola fom im wok, an meni of her famili membas, espeshially di wumen, run fom Gola bikos dem fear sry dem fit kidnap dem too.
Leta, shi wok as ticha an Adult Eduketor for Northern Nigeria, an shi even get big govment wok as Assistant Superintendent of Adult Education. Shi retire for di 1970s an later wok as ofisa for meni international research projects.
Muv to Benue an how shi return to Adamawa
[chenj-am | chenj-am for orijin]Di man wey kidnap am leta het transfer go Ibbi for Benue, an e kari Dadasare folo bodi. For di three years wey shi dey wit am, di ofisa uze her as sex slave sotey shi get belle bon pikin for am. Leta, di ofisa komot for Nigeria go England, Kon leav ha an di pikin. As shi dey travu go Adamawa, ha pikin die for river Benue bikos of malaria.
For her buk, shi rait: "I spend di night for one plez wey dem dey kol Bajabure. Mosquito plenti for di area. My pikin chop plenti mosquito bite, e quick get malaria, an bikos e no too strong, e die for my hand bifor we rish Gola. I no go fit talk di pain wey I feel."
How shi dey klose wit Rupert East
[chenj-am | chenj-am for orijin]As shi rish hauz, ha famili mari ha off to one man for di kommuniti, but shi no hapi. Shi don alredi taste di beta laife wey di colonial ofisa giv am. For 1933, one British man wey dem dey kol Rupert East, wey be big man for Northern Literature Agency (Gaskiya Corporation), kol am mek shi kom Zaria. Shi sabi am bifor bikos shi dey social circle of ha fest abductor. Shi lov am, an shi even tich am ha langwej, Fulfulde. Shi no waste taime bifor shi gree folo am go Zaria. Dat taime, shi bi 15 years, an Rupert East na 35 years. For her book, she rait:
"Dis taime, nobodi kidnap me. Na me gree by myself go meet di man wey I bliev sey e lov me. Enibodi wey don lov bifor go understand, enibodi wey neva lov no go fit understand."
For Zaria, shi bi di hostess for East house, wia big-big pipu, raiters an govment ofishials dey visit. East pay ticha mek e tich ha English an Hausa, an shi quick sabi read buk, including Hausa Bible wey shi rid three times even though shi bi Muslim. Rupert East leta mari anoda wuman, Jacqueline de Neyer, for UK, but e stil kip contact wit Dadasare. Shi even visit am for England. Wen e die for 1975, e leav plenti moni for Dadasare.
Wetin shi do for wok
[chenj-am | chenj-am for orijin]For di 1930s, wen shi dey Zaria wit Rupert East, shi stat wok as journalist for Gaskiya Tafi Kwabo, di fest Hausa niuspepa. Bifor shi get di job, shi rait letters to di editor wit fake nem, tok abaut difren palava lik how clinic no dey for Zaria. Di British govment vex, but di tok wey shi tok leta mek dem build clinic for di aria.
For Second World War time, shi volunteer as nors for Mission Hospital for Wusasa. Shi leta chenj religion to Christianity, but afta shi hear one racist praya wey blame di Fulani pipu for slav trade, shi go bak to Islam.
For 1949, shi waka go England go train as nors. She wok for Horton General Hospital for Banbury an leta for Plaistow Maternity Hospital for London until 1955. Wen shi return to Nigeria, shi kon bi matron for govment hospital for Zaria.
Leta, shi wok as ticha an Adult Eduketor for Northern Nigeria, an shi even get big govment wok as Assistant Superintendent of Adult Education. Shi retire for di 1970s an later wok as ofisa for meni international research projects.
For 1970, Nigeria honor ha wit di title Member of di Order of di Niger (MON), as one of di fest women wey dem giv di awod.
Wen shi kpai
[chenj-am | chenj-am for orijin]Dadasare kpai for August 1984, but her nem stil remain as one wuman wey faight meni battles for ha life an stil mek impact for Nigeria.