Jump to content

DJ Jimmy Jatt

From Wikipedia

Jimmy Jatt Amu (dem bon am asOluwaforijimi Adewale Amu on October 15, 1966) wey plenti pipu sabi am for im wok as DJ Jimmy Jatt, na pesin wey dey pley musik for pipu to njoi an dans an plenti pipu gree sey e dey insaid DJ wey fest stat to dey pley HipHop for parti insaid Nigeria. E fest stat to dey du HipHop bifor e chenj to DJ. Plenti pipu sabi am wit Jimmy Jump Off concert, wey e stat in 2008, an na one of di event wey plenti pipu wey dem sabi for entertainment dey like go. Insaid 2006, e win Hip Hop World Hall of Fame awod for di Headies an na bikos of how e tek hep hip-hop song for Nigeria.

How e stat life an wok

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Jimmy Amu na fom Ijebu Ode, Ogun Stet, but dem bon am an e gro for Lagos Island, Lagos Stet. Na for Legos e tek du im primari an sekondri edukeshon. Papa wey bon Jimmy dey du wetin dey produs musiksound wok. Jimmy Jatt don lik musik sins e dey smol. Wen e dey gro e don ear difren kain songs lik pop, afrojuju , highlife , afrobeat, jazz, hip-hop, rhythm and blues an soul .

Som of im wok

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Studio albums

[chenj-am | chenj-am for orijin]
  • The Definition (2007)
  • The Industry Vol 1 (2014)
  • Urban Heartbeat (2017)