Cossy Orjiakor

From Wikipedia
Cossy Orjiakor
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Nem for lokal langwejCossy Orjiakor Chenj-am
Orijina nemCossy Orjiakor Chenj-am
Wen dem bon amOctober 1984 Chenj-am
Ples wey dem bon amAnambra State Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej Chenj-am
Wok wey e dey dusinga Chenj-am
Wie e go skulLagos State University, University of Nigeria Chenj-am
Wen e stat wok2012 Chenj-am
Eye kolorbrown Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am
Instrumentvoice Chenj-am
Personal pronounL484 Chenj-am

Cossy Orjiakor (bon 16 October 1984) na Naija aktress and singa. Shi bikom popula wen shi feature inside Obesere music video and pipu sabi sey shi like to dey sho ha bress for music videos and party. For 2015, shi produce ha fest fim, Power girls, under ha produkshon compani playgirl pictures.

How shi tak stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Orjiakor wey wey dem bon 16 October 1984 for Anambra State. Shi graduate with second class upper in accounting and management for University of Nigeria, Nsukka and shi kolet master's digree from Lagos State University.

Persona life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Orjiakor bikom popula bikos of ha big bress,wey shi dey sho. Shi talk sey dem bi "great gift from God" and shi no go use dem bressfeed ha pikin make di bress fit dey kampe. Daily Post describe ha as di "boob star"of Nollywood.Vanguard describe ha as a "boobs toting" aktress and singa. For one interview with Encomium Magazine shi talk sey shi dey reason to bon pikin pass to marri. For August 2020, Orjiakor announce ha engagement to Abel Jurgen Wilhelm, one Naija - Germany fashion heritage model. Four months after, for December 2020, Abel sey I no du again bikos shi dey fight and bite am.

Karia[chenj-am | chenj-am for orijin]

Orjiakor don du differen things for di entatainment industri, shi don feature for music videos, shi don feature for fim, shi even get ha own album wey shi release for 2013 wey i nem bi "Nutty Queen" shi talk sey as shi dey sho ha bress so na I make ha tanda for di entatainment industri. But shi talk sey shJanuary 2013, one female blogger i no go fit naked for fim or music video. For January 2013, one female blogger advice ha to change ha lifestyle sey pipu don dey use dat kin eye dey look Igbo girls. Orjiakor talk sey di advice na act of "joblessness" and sey ha body don bring ha international recognition,Afta di arrest of one man wey nem i dog Buhari by Naija Police, Orjiakor talk for social media sey shi get two cat wey their nem na Buhari & Goodluck and shi sey mek dey kom arrest ha

Fim wey shi dey[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Itohan (directed by Chico Ejiro)
  • Ara Saraphina
  • Anini
  • Amobi
  • One million boys
  • Papa Ajasco