Christopher Nkunku
Christopher Alan Nkunku (dem bon 14 November 1997) na French futbola wey dey play hatakin midfida for Chelsea an France Nashona tim. Nkunku finish from Paris Saint-Germain Akedemi wey dey France. Na December 2015 e fest play futbol for PSG an na 78 times e play for dem. Wen Nkunku dey play for PSG, e helep dem kari three Ligi 1 tahitu, two Coupe de la Ligue. Nkunku join RB Leipzig wey de Germain in July 2019. For RB Leipzig, e net 70 goal an e play for dem for 172 times. Na four year Nkunku yuz for RB Leipzig. E helep di klub kari DFB-Pokal two time. Wen German Ligi wan nem playa wey play pass in 2021-22 Sisin, na Nkunku dey chuz. For 2022-23 Sisin, na Nkunku goal pass for Bundesliga. Chelsea sahin Nkunku in 2023 for £52 million. Nkunku don play for junior levul of France tim bifor e kom start to dey play for dia sinior Tim in March 2022.
How e tek start life
[chenj-am | chenj-am for orijin]Na for Lagny-sur-Marne, Seine-et-Marne dey bon Christopher Alan Nkunku on 14 November 1997. Nkunku go El Francis Assis Sekondiri skul. Wen Nkunku bi six-year, e start to dey play futbol for AS Marolles. In 2009, Nkunku join Fontainebleau an meni klub wey dey find smol smol playa to buy dey luk am. Nkunku go train for Lens, Le Harve, an Monaco but den no sahin am for dis klub-dem. Di risin wey di klub-dem give bi sey Nkunku too smol an e no get pawa. Paris Saint-Germain leta sahin Nkunku an e kom dey play for dia Onda-15 tim side kol INF Clairefontaine. From Mondey to Thurdey, Nkunku dey play for INF Clairefontaine but for wi-kend na Paris Saint-Germain e dey play for. E start to dey play for onli Paris Saint-Germain wen e rish fiftin year. Nkunku join Paris Saint-Germain smol tim in 2010. E de for PSG Tim wey Kari sekod in di 2015-16 UEFA Shampion Ligi. Nkunku start to dey play for PSG sinior tim on 8 December 2015. Dat day, Nkunku enta for Lucas Moura wen PSG dey play Shaktar Donetsk. Di game finish 2:0 an na Nkunku tim win di game.