Chris Okotie

From Wikipedia

Dem bon Christopher Oghenebrorie Okotie for 16 June 1958, na Naija pesin wey dey prish for televishon an na pastoh e bi for di Household of God Church International Ministries, wey bi Pentecostal congregation for Lagos sins February 1987.

Im Pasona Laif[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na Francis Idje an Cecilia Okotie bon Okotie for Ethiope-West, for Delta State wey bi bifor bifor Bendel State. Wen him dey stat tu dey grow, he kom dey laik tu dey sing, wen e dey for sekondri skul for Benin City, e dey for di skul musik klob wey dem dey entaten grup of pipul dem from taim to taim. Dat taim e neva tink am sey e wan yus dat e talent wey bi tu dey sing for biznes mata, or tu mek moni, ontil e fest year for yunivesiti wen him papa dai. Na pesin wey laik tu dey du jogging, martial arts, an e laik musik.

Im Edukashon an Karia[chenj-am | chenj-am for orijin]

He go tu Ẹdo kolej sekondri skul for Benin City. For 1984, he graduet an get digri for law mata for Naija from di University of Nsukka. Okotie komot from skul to fest poshu im musik Karia bifor e kom bak to skul. Na two taim na e he mari an leta for June 24, 2012 he tok sey im no dey wit di sekond waif agen. He go bak to skul to finish e edukashon an e kom graduet wit law digri, for dat sem taim wey e still dey for skul e also komot go dey do im rilijion wok. Okotie dat taim stat tu dey go Grace Fellowship Bible School for Tulsa, wey dey for Oklahoma, an e no kom far, for 1990, he kom establish di annual Karis Awards, wey bi sey na im shorsh dey host am tu sabi an giv Naija sitizin dem money as gift.

For Korona Virus Taim[chenj-am | chenj-am for orijin]

For August 2020 wey Naija govment tok sey mek dem opun shorsh dem for Naija, an dey make am komposri for shorsh memba dem tu dey yus dia nos kova or dia fez kova, Pastor Okotie komdem di aidia sey tu dey yus nos kova go shorsh go bi laik sey dem want stat tu dey do wetin don stop tu dey hapun sins di day wey Christ don dai an e even tok sey e go meen tu kriet sepreshon bitwin man an God.

Di Grace or Karis Awod Program[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na one kaind program wey dem dey do evri year tu show pipu pity an hep pipul dem, wey bi sey wetin mek di Lagos pastor dem for di House Hold of God International Ministries dem dey du am bi sey, dem risin am sey sens no dey tu bi beta pesin if yu no mek oda pipul laif beta tu. Na e mek dem dey do di Karis awod, dem yus di awod tek dey rekognaiz pipul wey don du beta tins tu biuld di neshon, wey pipul no sabi dem an dem dey rewod dem fo di beta tin wey dem du tu build di neshon. Som of di pipul wey dey don giv di awod na;

Prof. Chike Obi wey bi mathematician (1996),

D.I.G. Chris Omeben na retayad poleesman (1997),

Mr. Taiwo Akinwunmi wey disain di nashona flag (1998),

Hogan Bassey na fohma Commonwealth and World boxing champion (1999),

Chief Michael Imodou di Labour leader (2000),

Chief Margaret Ekpo na nationalist and woman activist (2001),

Mallam Aminu Kano na nationalist

Isaac Adaka Boro human rights activist (2005).

Di Grace program dey evun mek kontribushon an dey giv regula moni an matiria tins fo shariti join bodi dem laik di;

SOS Children Village,

the Sunshine Foundation,

Pacelli School for the Blind

Partially Sighted and Little Saints Orphanage,

Spinal Cord Injuries Association of Nigeria, an di Childcare Trust.

Tins Wey E Get[chenj-am | chenj-am for orijin]

Fo 2011, di join bodi wey bi Forbes estimet tins wey e get sey e rish US$3–10 million.

Wen He Kontes Foh President[chenj-am | chenj-am for orijin]

Okotie don fes kontes foh President onda di bana wey bi di Justice Party (JP), wey bi sey na Ralph Obiorah kom leed foh di parti, afta him komot from di National Democratic Party (NDP) pramari elekshon dem, Olusegun Obasanjo kom win am foh di elekshon wey hapun foh May 2003. E kom out agen for 2007 onda di platfom for di parti wey him fom for e sef wey bi Fresh Democratic Party (FRESH) and e kom loos tu Umaru Yar'Adua foh di elekshon wey hapun foh May 2007. For 2011, he kom out kom kontes agen na dat taim President Goodluck Jonathan kom win am.

Misunderstanding Wit E Fellow Pastoh[chenj-am | chenj-am for orijin]

Okotie get poblik katakata wit him fellow Naija Pastoh wey bi T.B Joshua, wey mek e tok sey na pesin wey dey yus konni konni tek dey do majik.

Buk Dem Wey E Don Rait[chenj-am | chenj-am for orijin]

The Last Outcast (na best buk wey sell well foh 2001)

A terror war beyond hashtags

A conference of geriatrics

In search of game changers

Power shift: what my readers say

Why Vision 20:2020 became a lost cause

State policies and prophetic solutions

Adadevoh and the Ebola crisis

A Government stuck in timing response snafu

This present assault on education

Rage over villaleaks et al

Time to shift Governance paradigm

2015: Imperative of the paradigm shift option

ASUU strike: implications of political infidelity

Counting the cost of insecurity

The looming demographic time bomb

Reclaiming Nigeria's lost hope.

Wia We Si Pruf[chenj-am | chenj-am for orijin]