Jump to content

Chioma Okereke

From Wikipedia

Chioma Okereke na Naija poet, raita wey dey rait shot tori. Ha fest buk, Bitter Leaf (2010), mek am rish final stej for Commonwealth Writers' Prize – Africa Best First Book 2011.

How ha life bi

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Chioma Okereke for Benin City, Nigeria. Wen shi dey six years old, shi komot go Britain. For dia, shi go meni boarding skul bifor shi finish her last two years for North London Collegiate Skul wey dey Canons, Middlesex. Shi leta go University College London go stodi lor, an shi finish wit LLB digre.

As poet an short tori raita, shi don paform for difren kontri. Ha earli wok sho for Bum Rush The Page an Callaloo magazine. For 2006, dem shortlist ha for Undiscovered Authors Competition, an for 2007, shi mek am rish final stej for Daily Telegraph Write a Novel in a Year Competition.

Ha fest buk, Bitter Leaf, wey Virago Press poblish for 2010, mek am rish final stej for Commonwealth Writers' Prize – Africa Best First Book 2011.

Ha short tori, "Trompette de la Mort", kom bi Fest Runner-up for the first-ever Costa Short Story Award inside 2012 Costa Book Awards. Shi also put ha wok insaide Virago is 40 anthology for 2013.

Ha niu buk, Water Baby (April 2024), na tori wey tok abaut how one young girl wey dey gro for Makoko, Lagos, dey struggle with society palava. Bikos of how the plez bi, Chioma Okereke kom stat Makoko Pearls, one UK charity wey dey help reduce poverty for Makoko and bring beta life for di people wey dey dia.

Wia dem gada tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]