Chinyere Udoma
| Man abi wuman | wuman |
|---|---|
| Kontri wey e kom from | Naija |
| Fest nem | Chinyere |
| Famili nem | Udoma |
| Wen dem bon am | 1976 |
| Ples wey dem bon am | Ibadan |
| Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tok | English langwej, Igbo langwej, Naijá langwej |
| Wok wey e dey du | singer-songwriter |
| Pat of wok wey e put mind | gospel music |
| Wie e go skul | University of Nigeria |
| Hair kolor | black hair |
Chinyere Udoma (dey bon am in 1976) na Naija wuman wey bi muzishan, singa, an song-raita. Chinyere Udoma like to dey yuz Igbo langwej to sing wel wel. For 2018, e rilis one song wey di tahitu na "Adim Well Loaded"
How im tek start life an go skul
[chenj-am | chenj-am for orijin]Udoma kom from di Igbo tribe but na Ibadan dey bon am. Udoma go Yunivasiti of Nigeria go rid Mass Komunikeshon.
Udoma fest start to dey sing as kwaya for St Mary's Katolik Church wey de Nnokwa. Na for dat kwaya pipo start to dey notis am smol smol. For 1999, Udoma rilis im fest song ''Ị dịghị ajọ njọ". For di show wey hapun in 2018, Udoma join Cece Winans enta stej sing togeda. Di nem of dat event na: "Women of Praise".
E pasonal life
[chenj-am | chenj-am for orijin]Udoma hosband na Ifeanyi Akaekpuchionwa. Udoma tok sey na for one church krused dey jam demsef wey leta lid to marej.
Awod an Nomineshon
[chenj-am | chenj-am for orijin]Udoma song don enta CLIMA awards. One muzikal edukeshon African Contemporary Musical Education tok beta tins about Udoma fest habom wey bi "Agu N'eche mba". Di muzikal edukeshon evun kol di habom Christology". One mazasin wey dia nem bi Stone Magazine give Udoma di Best Gospel Hatis of di year for South East Nigeria in 2022.
E nem de di Most outstanding music minista of di year for di 2023 CLIMA AFRICA AWARDS.
E habom
[chenj-am | chenj-am for orijin]- Idighi Ajo Njo (1999)
- Agu N’eche Mba (2000)
- Divine Praise (2001)
- Evergreen Worship (2001)
- Chim Si Afo N’afo Goziem (2002)
- Omeokachie (2002)
- Chim Mechiri Akwukwo (2003)
- Pure Praise (2005)
- Pure Praise 2 (2008)
- Wind of Glory (2009)
- Adim Well Loaded (2010)
- It’s Done (Omewo Ya) (2013)
- Marvelous God (2016)
- Manifestation Time (Udo Di) (2016)
- Endless (2019)
- Merciful God (2021)
- Walk With Jesus (2021)
- Eze Mmuo (ENDLESS WALK WITH JESUS RELOADED) (2023)
Singu
[chenj-am | chenj-am for orijin]- Adim Well Loaded
- Pure Praise
- Wind Of Glory
- To You Be All The Glory
- Jesus Surprise Me
- Come and See
- The Marvelous God
- Jehovah Mara Over
- Oke Ebube
- Chimamaka
- Imenem l
- Ebenebe
- Eze Abata