Chikwenye Okonjo Ogunyemi
Chikwenye Okonjo Ogunyemi (wey dem bon for 1939) na Naija akademik, pesin wey sabi buk wel wel, an e bi raiter. Shi tich for Sarah Lawrence College, an pipu sabi am wel bikos of di buk an article wey shi raite abaut Womanism an Afrikan pipu wey don waka go difren pat of di world.
Ha wok
[chenj-am | chenj-am for orijin]For 1996, Ogunyemi publish one buk wey dem kol "Africa Wo/man Palava: The Nigerian Novel by Women". For di buk, shi tok abaut di wok of eight Nigerian women wey dey rait novel:
- Zaynab Alkali
- Simi Bedford
- Buchi Emecheta
- Funmilayo Fakunle
- Flora Nwapa
- Eno Obong
- Ifeoma Okoye
- Adaora Lily Ulasi
Ogunyemi uze di buk tek explain niu idea abaut Nigerian literature, espeshially di one wey dey abaut wumen. Ha theory join both womanism an feminism, but shi stil tok sey di nem wey pesin giv sometin fit bi politika mata. Shi no wan just put di raiters for one small corner or sey dem dey tok onli one kian tin.
Shi join hand wit oda pipu lik Helen Chukwuma an Omolara Ogundipe-Leslie abaut how African literature don change sins colonial taime. Shi stil tok bad abaut di wok of som critics wey shi kol "phallic critics"— wey mean men wey dey analyze buk fom onli man-eye witout consider women own.
Di taime wey shi dey Sarah Lawrence College for New York, shi bi profesor of literature an shi also bi chair of global studies. Shi wok wit Tuzyline Jita Allan to edit one kollection of essays wey dem kol "Twelve Best Books by African Women: Critical Readings" wey come out for 2009.
Som of ha buks
[chenj-am | chenj-am for orijin]- Twelve Best Books by African Women: Critical Readings (2009) – Edited with Tuzyline Jita Allan
- Juju Fission: Women’s Alternative Fictions from the Sahara, the Kalahari, and the Oases In-Between (2007)
- Africa Wo/man Palava: The Nigerian Novel by Women (1996)
- Womanism: The Dynamics of the Contemporary Black Female Novel in English (1985) – Journal article
Ogunyemi na strong voice for African literature, espeshialy for how women dey rait an tel dia own stori.