Chibundu Onuzo
Imachibundu Oluwadara Onuzo FRSL (wey dem bon for 1991) na Naija raita. Ha fest buk, The Spider King's Daughter, win Betty Trask Awod. E stil enta shortlist for Dylan Thomas Prize an Commonwealth Book Prize, plus e dey longlist for Desmond Elliott Prize an Etisalat Prize for Literature.
Ha life stori
[chenj-am | chenj-am for orijin]Chibundu Onuzo na Naija pesin, dem bon am for 1991, an shi bi di last bon for ha papa an mama wey bi doktors. Shi gro for Lagos bifor shi waka go England wen shi bi 14 years old to kontinue skul for St Swithun’s School, Winchester, Hampshire. Na for dia shi do ha GCSE exams.
Wen shi dey age 17, shi stat to rait ha first novel, an two years leta, one big buk kompini, Faber an Faber, sign am. By di taime shi rish 21, dem don poblish di buk, an shi bi di youngest wuman wey don eva poblish buk for dat kompani. Wen shi rait ha sekond buk, Welcome to Lagos (2016), one big raita, Helon Habila, tok sey Chibundu sabi bring characters to life wel-wel, an di wey shi tek tok abaut Lagos for di buk dey speshial.
Shi go King's College London go stodi histri, an shi finish wit first-class result for 2012. Afta dat, shi do master's digre for poblik policy for University College London. Shi stil do PhD for King’s College London, wia shi stodi di histri of di West African Students’ Union.
Shi don rait for difren newspaper an media houses lik The Guardian an NPR. Shi also rait short stori wey dem kol "Sunita" for di 2019 buk collection New Daughters of Africa, wey Margaret Busby edit. For 2021, shi poblish ha third buk Sankofa, wey Virago relis for UK. One review fom The Guardian tok sey di buk "dey well-written an e sho wetin e mean to belong or bi different." Brittle Paper tok sey di book be "love stori, politika histri, an father-daughter drama" join. Dem publish Sankofa for US onda Catapult an for Nigeria onda Narrative Landscape.
Awods an recognition
[chenj-am | chenj-am for orijin]- The Spider King’s Daughter win Betty Trask Award for 2013.
- Di buk stil enta shortlist for Dylan Thomas Prize an Commonwealth Book Prize for 2012.
- E enta longlist for Desmond Elliott Prize an Etisalat Prize for Literature for 2013.
- For April 2014, dem put Chibundu Onuzo nem insaide Africa39 list—wey bi 39 young African raiters wey fit influence Afrika literature for di future.
- For June 2018, dem chuz am as Fellow of di Royal Society of Literature under di "40 Under 40" program.
- For 2020, di fim Dọlápọ̀ Is Fine, wey shi co-rait, win HBO Short Film Competition for di American Black Film Festival. Dis film, wey Joan Iyiola dairect, stil enta longlist for Bafta British short fim awod.
- For April 2014, dem put Chibundu Onuzo nem insaide Africa39 list—wey bi 39 young African raiters wey fit influence Afrika literature for di future.
- For June 2018, dem chuz am as Fellow of di Royal Society of Literature under di "40 Under 40" program.
- For 2020, di fim Dọlápọ̀ Is Fine, wey shi co-rait, win HBO Short Film Competition for di American Black Film Festival. Dis film, wey Joan Iyiola dairect, stil enta longlist for Bafta British short fim awod.