Jump to content

Chiamaka Okwuchukwu

From Wikipedia

Chiamaka Cristabel Okwuchukwu (wey dem bon for 7 August 2005) na Naija futbola playa wey dey pley as forward for San Diego Wave FC wey dey for National Women's Soccer League (NWSL). Shi don olso represent Nigeria for youth levu intanashonal futbol.

How ha life tek stat

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Chiamaka for 7 August 2005. Shi be nomba seven for eight chudren wey dem bon for dia famili. Shi gro up for Njaba town.

Rivers Angels

Bifor shi travu go abroad, shi don play for Rivers Angels, di team wey don win NWFL Premiership seven taims.

San Diego Wave

For 13 January 2025, San Diego Wave FC for NWSL anous say dem don saihn Chiamaka for one-year kontrat, afta dem pay transfer moni (dem no tok di amount) to Rivers Angels.

Shi skore ha first NWSL goal less dan two minutes afta shi enta pitch for ha first match, evun though ha teem luz 2–1 to Orlando Pride on 29 March 2025.

Shi skore ha first NWSL goal less dan two minutes afta shi enta pitch for ha first match, evun though ha teem luz 2–1 to Orlando Pride on 29 March 2025.

For di next match, shi stat di game for di first taim, but San Diego Wave stil luz 2–0 to Kansas City Current.

Afta dat, shi play one more match for di 2025 season bifor leg injury hold her down and mek shi miss di rest of di games.

How shi tek play for Nigeria

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Okwuchukwu play for ol di four matches (two shi stat) for Nigeria during di 2022 FIFA U-20 Women's World Cup wen shi bi 16 years old. Shi hep di team top dia group, but dem luz to Netherlands for quarterfinals.

For di nex World Cup (2024 FIFA U-20 Women's World Cup), shi play again for ol four matches (three shi stat). Shi skore two goals and giv one assist for di grup stej.

Shi skore one goal (anoda one referee kansu say e be offside) for 3–1 loss to Germany, and shi olso skore and assist di first two goals for 4–0 win against Venezuela.

Wen shi skore against Germany, shi do Cristiano Ronaldo stai bikos na im bi ha futbol idol.

Nigeria finish sekond for dia grup, but dem luz to Japan for di first knockout round (Japan leta rish final).

Bikos of how wel shi pley, CAF shortlist ha as one of di three finalists for Youth Women's Player of di Year (2024), but Morocco playa, Doha El Madani, win am.

Wia dem gada tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]