Jump to content

Charry Ada Onwu

From Wikipedia

Charry Ada Onwu-Otuyelu na Naija pesin wey dey rait buk, an e dey rait plenti for chudren. Shi bi di first wuman wey bi Dairekto for Imo State Council for Arts an Culture. Shi kom fom Amaigbo for Imo State. Shi sabi rait fiction, eshially chudren stori dem.

Na shi bi bifor bifor solja wey wok wit di Armed Forces Medical Service insaid Biafra war. Ha buk dey tok abaut folktale an histri.

E get as shi lik folktale an histri wel wel, na im mek shi focus ha research for histri an sociology. Na di sem tin mek shi uze folktale an histri as topik for som of ha buks dem. Som of di buk wey shi rait na: Catastrophe, Our Grannies Tales, Adobi, Triumph of Destiny, One Bad Turn, Ada Marries a Palm Tree, Amaigbo Kwenu: History of My Town, Good Morning Mr Kolanut, an odas.

For di earli 1980s, Charry Ada Onwu-Otuyelu tek chudren literature Crious wel wel. Shi stat to rait creative stories for chudren, an one of ha fest buks, Ifeanyi an Obi, win chudren literature awod for 1988. As taime dey go, shi rait plenti oda buks wey win awods bikos shi sabi how to rait storis wey chudren go enjoi.

Apat fom raitin, Charry na nurse. Shi go skul for University Teaching Hospital Ibadan an Maternity Hospital Lagos to len nursing. Pipu tok sey shi get clinic/maternity for Obinze, near Owerri, Imo State kapital. Ha frend Chukwubuike tok sey shi bi civil war veteran wey sarf for Biafran Armed Forces Medical Service during Nigeria-Biafra Civil War (1967-1970). But na ha raiting mek pipu sabi ha wel wel, jos lik Cyprian Ekwensi an Anezi Okoro, wey stil bi medical pipu but na big nem for literature.

Som of ha buks

[chenj-am | chenj-am for orijin]
  • Good Morning Mr. Kolanut! (2006; wey she write with Ama Boatemaa and Samuel Boamah)
  • Triumph of Destiny (2003)
  • Amaigbo Kwenu: History, Legend & Myth of Amaigbo (1988)
  • Catastrophe: A Novel (1982)

Wia dem gada tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]